34
King Josaya Rule Judah
Josaya na eight years wen e start to rule and e rule for thirty-one years from Jerusalem. E do wetin God wont kon follow David wey bi en grand-grand papa footstep, e nor turn go left or rite.
For di eight years wen e dey rule, even doh e still dey yong, e start to serve God wey en grand-grand papa David serve. For di twelft year, e bigin distroy all di place where dem for dey serve juju: Asherah juju and all di oda juju. E give orda sey make dem distroy Baal juju kon skata di incense altar wey dey on-top dem. E skata and grind Asherah juju, di oda juju and dia image, den e pour dia dust on-top di juju savant graves. E burn di juju priest bones for di altars where dem for dey woship before. Bikos of all dis tins wey e do, Judah and Jerusalem kon dey holy again. E do di same tin for Manasseh, Efraim and Simeon land go rish Naftali and all di towns wey dey near dem. E distroy di altar, Asherah juju and di oda juju kon skata all di incense altars wey dey for Israel town, den e go back to Jerusalem.
For di eighteent year wen e dey rule, e kontinue to dey make di land and di temple holy. King Josaya tell Shafan wey Azalaya born, Maaseaya wey bi Jerusalem govnor and Joah wey bi di high offisa Jehoahaz pikin sey, “Make una go ripair di Oga awa God, temple.”
Di money wey Levi pipol wey dey guide don kollect for di temple, dem pak and gi-am to Hilkaya wey bi di High Priest. (Dem kollect am from Manasseh, Efraim and all di pipol wey remain for Israel, Judah, Benjamin and Jerusalem.) 10 Dem kon give di money to di three men wey dey ripair di temple wey 11 leta give di karpenters and doz wey dey build, so dat dem go use am take buy strong stones and timba, to take ripair di house wey Judah kings bin skata.
12 Di men work with all dia mind and di four Levi men wey dey supavise dem na: Jahat and Obadaya from Merari; Zekaraya and Meshullam from Kohat family. (All Levi pipol wey dey der, sabi sing well-well.) 13 Oda Levi pipol still dey supavise difren works, while some na guards and ofisas.
14 Wen dem remove di silva wey dem bring kom God Temple, Priest Hilkaya kon si di Law Book wey God give Moses. 15 Priest Hilkaya tell Shafan. “I don si di Law Book for God Temple.” Den e give di book to Shafan.
16 Shafan take di book go give di king kon sey, “Yor savants dey do evritin wey dem give dem. 17 Dem melt di silva for God Temple kon gi-am to doz wey dey supavise dia work.” 18 Shafan still tell di king, “Na Priest Hilkaya give mi dis book.” Den Shafan shaut as e dey read wetin dey di book give di king.
19 Wen di king hear di words wey dem rite for di Law Book, e kon tear en klot. 20 Di king sey make Priest Hilkaya orda Ahikam wey bi Shafan pikin; Abdon wey Mikah born; Shafan wey bi di seketry and Asaya wey bi di king savant sey: 21 “Make una go pray give God for mi and di pipol wey remain for Judah and Israel. Den ask am about di words wey dey dis book wey dem si, bikos God dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor obey en word as dem rite am for dis book!”
22 So Priest Hilkaya and di oda pipol wey di king send with dem kon go meet Profetes Hulda wey dey stay di new part for Jerusalem. (En husband na Shallum wey Tokhat born and na Hasrah wey dey kare for di temple robe, bi en grand-papa.)
Dem kon tell di woman evritin wey happen, 23 den di woman sey, “Make una go tell di king, 24 ‘God sey: “I go ponish Jerusalem and all di pipol with di curse dem wey dey inside dis book wey dem read gi-am. 25 Dem don rijet mi kon dey sakrifice give oda gods, so I dey vex for wetin dem do. I dey vex naw for Jerusalem and nor-tin go fit stop mi make I nor ponish dem.” ’ 26 And for di king ensef, dis na wetin di Oga God dey tok: ‘Yu don listin to evritin wey dem rite for dis book 27 and yu kom turn from sin kom meet mi, as yu tear yor klot dey kry wen yu hear sey I won ponish Jerusalem with en pipol. I don hear una prayer. 28 So, I go let una die make dem beri una with peace. Una nor go si di wahala wey I won bring kom Jerusalem.’ ”
So dem kon go tell di king dis tins.
29 Di king koll all di leaders for Judah and Jerusalem 30 kon gada di pipol, di priest, Levi pipol; both old and yong pipol go God Temple and e shaut read wetin dem rite for di Law Book wey dem si for di temple. 31 Di king stand near di pila kon make new kovenant with God sey dem go follow en kommand, laws and rules wey dem rite for di book with all dia heart.
32 E make all di pipol wey dey Jerusalem and Benjamin gri sey dem go do am. Pipol for Jerusalem follow di Oga wey bi dia grand-grand papa God kon obey en kovenant.
33 King Josaya remove all di juju from Israel pipol aria kon advise dem sey make dem serve God. For di time wen Josaya dey rule, di pipol nor sin against di Oga wey bi dia grand-grand papa God.