36
King Jehoahaz Rule Judah
Di pipol for di land take Josaya pikin Jehoahaz kon make am king for Jerusalem. Jehoahaz na twenty-three years wen e start to rule and e rule three monts from Jerusalem. King Neko for Egypt take am go prison kon sey make Judah pipol pay 7,500 pounds for silva and 75 pound for gold as tax to am. Egypt king kon make Eliakim wey bi Jehoahaz broda king for Judah and Jerusalem and dem shange en name to Jehoiakim. King Neko karry Jehoahaz go Egypt.
King Jehoiakim
Jehoiakim na twenty-five years wen dem make am king and e rule eleven years from Jerusalem. E do wiked and bad tins before God. King Nebukadnezzar for Babilon attack Jehoiakim, use bronze take shain am kon karry am go Babilon. King Nebukadnezzar take some of di tins wey dey God Temple go Babilon kon put dem for en palis.
Di remainin tins wey Jehoiakim do wen e dey rule, all di big-big sins and bad tins wey e do, dem rite dem for Israel and Judah kings history book. En pikin Jehoiashin kon take-ova as king.
King Jehoiashin
Jehoiashin na eighteen years wen e start to rule and e rule three monts and ten days from Jerusalem. E nor gri obey God. 10 Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.
King Zedekaya
11 Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule and e rule eleven years from Jerusalem. 12 E do wiked and bad tins for God eyes. E nor honbol ensef to Profet Jeremaya wey bi God savant. 13 King Zedekaya attack King Nebukadnezzar wey don make am swear with God name sey e go dey loyal to am. King Zedekaya sturbon well-well and e nor gri turn from sin kom meet di Oga wey bi Israel God. 14 All di priests and leaders nor kon dey faithful again and dem kon dey kommit bad-bad sins wey all di oda nashon dey kommit. Dem nor kon make God temple for Jerusalem holy again.
Babilon Distroy Jerusalem
15 God wey bi dia grand-grand papa God always dey warn dem, bikos E dey pity for en pipol and Jerusalem wey bi en house. 16 But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex. 17 E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king. 18 Di king karry all di tins wey dey God Temple go Babilon; weda di tins big or small, plus all di tins wey dem keep for God Temple, Israel kings and en ofisas store room. 19 Dem burn God Temple kon skata Jerusalem wall. Dem burn all di towns wey dem fence kon distroy all dia betta-betta tins.
20 Di king karry all di pipol wey e nor kill go Babilon as slave and dem serve en and en shidren till Persia kingdom start to reign. 21 So, wetin God tok thru Profet Jeremaya kon happen. “Dem go abandon di land; di land go rest well-well until di seventy years don komplete just as God tok am.”
Jerusalem Pipol
22 To take fulfil wetin God promise Israel pipol thru Profet Jeremaya, God kon make King Cyrus for Persia rite law give all of dem for en kingdom for di first year wen e start to rule.
23 Wetin dem rite na: “King Cyrus for Persia sey: ‘Di Oga God wey dey heaven don give mi all di kingdoms for di world. E don choose mi to build temple for am for Jerusalem wey dey Judah. Naw, make all of una wey bi God pipol go back and di Oga una God go dey with una.’ ”