2
God Judgement
Pesin wey dey judge odas nor get eskuse for wetin e dey do and e nor matter who en bi. Bikos wen yu judge odas and yu dey do di same tin wey dem dey do, yu dey kondemn yorsef. Wi know sey God nor dey lie wen E dey judge pipol wey dey do bad tins. Yu wey dey do tins wey yu sey make odas nor do! Yu tink sey yu go eskape God judgement? May bi una dey take God kindness, patient and endurance as yeye tins. Una nor know sey God dey kind, bikos E wont make una turn from sin kom meet am? But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, for di Day wen God go judge di world, bikos en na judge wey nor dey support bad tins. God go pay evry man akordin to wetin e do. God go give life wey nor dey end to di pipol wey dey do good, wey wont glory, honor and long life. But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins. Anybody wey dey do bad tin, weda e bi Jew or Gentile, must sofa and receive ponishment. 10 But God go give glory, honor and peace to anybody wey dey do good, weda e bi Jew or Gentile, 11 bikos God go judge evribody di same way. 12 Even doh Gentile pipol nor get Moses Law, God still dey ponish dem wen dem sin, so Jew pipol wey get di law, wen dem sin, na di law go judge dem. 13 Bikos yu dey hear di law nor mean sey yu good for God eye, but na wen yu do wetin di law tok. 14 Gentile pipol nor get di law, but dem dey use dia sense do wetin di law tok and dat one don turn law for dem, even doh dem nor know Moses Law. 15 Di way dem dey bihave show sey wetin Moses rite for di law, dey dia heart and dia mind dey tell dem sey, “Dis tins dey rite and e go kondemn or free us from wetin wi do.” 16 So just as I prish give una, na so e go bi for dat day, wen God go judge all di sekret tins wey dey pipol heart thru Jesus Christ wey bi en pikin.
Jew Pipol And Di Law
17 Wot of yu wey sey yu bi Jew? Yu wey put yor hope for di law kon dey use God dey boast; 18 yu know wetin God wont make yu do and yu don learn how to do good tins, bikos yu know di law. 19 Yu dey show blind pipol road and dey help doz wey dey for darkness si lite, 20 and yu dey tish foolish pipol and small shidren wey nor know anytin, bikos yu know sey, di trut and evritin wey man nid to know, dey for di law. 21 Yu wey dey tish odas, why yu nor fit tish yorsef? Yu wey dey prish sey make pipol nor tif, yu sure sey yu nor dey tif? 22 Yu wey sey make pipol nor kommit adultery, yu nor dey kommit adultery? Yu wey sey yu hate juju, yu nor dey take tins wey dem keep for juju house? 23 Yu wey dey take di law boast, yu dey bring shame to God name, bikos yu dey disobey di law! 24 Just as God word sey, “Bikos of una wey bi Jew pipol, Gentile pipol dey take God name make yeye.”
25 Sekonsishon get value only if yu dey do wetin di law tok, but if yu nor dey obey di law, yu and di pesin wey dem neva sekonsaiz na di same. 26 So if Gentile pipol wey dem nor sekonsaiz dey obey evritin for di law, yu nor tink sey God go take dem as pipol wey dem sekonsaiz? 27 Yu nor know sey di pesin wey dem nor sekonsaiz go judge yu wey bi Jew, since yu dey break di law? 28 Pesin nor bi Jew bikos of wetin pipol si from outside. Di really sekonsishon nor bi wetin pipol dey si, 29 but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.