14
Di Lamb And 144,000 Pipol
Den I si di Lamb stand on-top Mount Zion with 144,000 pipol. Dem rite en name with en Papa name for dia fore head. And I hear one loud vois from heaven like wave for sea or tonda for sky. I hear anoda sound like harp wey dem dey play. Dem kon dey sing new song for di throne, di for creatures and di eldas front. Nobody fit learn di song, escept di 144,000 pipol wey God save from dis eart.
Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok. Lie-lie nor dey dia mout and dem nor get any fault.
Three Angels
Den I si anoda angel dey fly for sky and e karry di Good News wey go dey forever dey kom prish give di pipol for dis eart, kountries, tribes, language and groups. Di angel kon shaut: “Make una dey fear and give God glory, bikos di time wey E go judge di world, don rish. And make una woship di Pesin wey make heaven, eart, sea and where wota from dey flow!”
Anoda angel follow di first one kon sey: “E don fall! Babilon don fall! Babilon wey make all di kountries drink di wine wey make dem dey sleep with who dem nor marry.”
Di third angel kon follow di first two, dey shaut: “If anybody woship di beast and en image kon kollect di mark for en fore head or hand, 10 e go drink from God vexnashon wey dey inside en ponishment cup. God go ponish am with fire and sulfur for en holy angels and Lamb front. 11 Di smoke from dis sofa go dey go up forever and ever. Doz wey dey woship di beast, en image and doz wey kollect di mark, nor go rest for day or nite.” 12 Dis mean sey, God pipol go bear well-well, bikos dem dey obey en kommandment and get faith for Christ.
13 Den I hear one vois from heaven dey sey, “Make yu rite dis tins:
“God don bless pipol
wey bilive and obey Christ before dem die!”
Di Spirit sey, “Blessing go really follow dis pipol and dem go rest from dia hard work, bikos of di good wey dem do.”
14 Den I look kon si one white kloud and di pesin wey sidan on-top, bi like Man Pikin! E wear gold crown for head kon whole sharp knife for hand. 15 Den anoda angel kom out from di temple kon tell di one wey sidan on-top di kloud, “Make yu start to harvest with yor knife, bikos na di korrect time bi dis and di fruits for eart don ripe!” 16 So di pesin wey sidan on-top di kloud, take en knife klear di eart kon harvest evritin wey dey inside.
17 Den anoda angel kom out from di temple for heaven with sharp knife for en hand. 18 Anoda angel still kom out from di altar and e get pawa to kontrol di fire. Di angel koll di one wey hold di sharp knife kon tell am, “Make yu use yor sharp knife gada di grapes for di vine for eart, bikos dem don ripe rish to plok.” 19 So di angel klear di eart with en knife, gada di grapes from di vine kon trow dem put for where dem go press dem and dis na God sirious vexnashon. 20 Den, dem press di grapes for outside di town and blood rush kom out from di place where dem dey press dem. Di blood high rish five fit and e nearly rush rish two hundred mile.