16
Di Basin
Den I hear one loud vois dey tok to di angels from di temple sey: “Di seven basins wey God vexnashon dey, make una go pour dem for di eart.” So di first angel pour wetin dey en basin put for di eart. Den di pipol wey get di beast mark and doz wey dey woship en image kon get sore wey dey pain well-well for dia body.
Di sekond angel pour wetin dey en basin put for di sea. Den di sea turn to blood and evritin wey dey inside, kon die.
Di third angel pour wetin dey en basin put for river. Di river and di wota wey dey flow pass, kon turn to blood. Den I hear di angel wey get pawa ova di wota dey sey: “Di Pesin wey dey since, wey dey naw, di Holy One, na yu dey good, bikos yu don judge well. Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”
Den I hear one vois from di altar sey, “Yes, Oga God, yu wey get all pawa, yor judgement na true and dem korrect!”
Den di fourt angel pour wetin dey en basin put for di sun and di sun kon dey shine with heat wey bi like fire, den di heat kon dey burn pipol, yet dem still dey curse God wey get pawa to stop dis sofa and dem nor gri turn from sin kom meet God or gi-am all di glory.
10 Den di fift angel pour wetin dey en basin put for di beast throne, at wons, darkness kover di beast kingdom and di pain kon dey make dem bite dia tongue. 11 Dem still dey curse God wey dey heaven bikos of di sofa and di sore wey full dia body, but dem nor still gri turn from sin kom meet God.
12 Den di sixt angel pour wetin dey en basin put for River Eufrates. Di river dry and road kon dey for di kings wey dey kom from east. 13 Den, I si three evil spirit wey resemble frog dey kom out from di dragon, di beast and di fake profets mout. 14 Na dem bi demon spirit wey dey do mirakle. Na dem dey go gada all di kings wey dey for di world, so dat dem go fight di fight wey go happen for di day wey God Almighty go judge di world. 15 Look! I go kom like tif! God don bless di pesin wey go shine en eye and wear en klot, so dat e nor go naked waka.
16 Di demon spirit gada di kings and dia sojas for di place wey Hibru pipol dey koll, “Armageddon.”
17 Finally, di sevent angel kon pour wetin dey inside en basin put for di air. Den one loud vois tok from di throne inside di temple sey, “Dem don do am finish!” 18 Den tonda lite, like lion vois kon dey make nois and strong eartkweke kon happen. Dis kind eartkweke neva happen since wen God kreate di world. 19 Den di big town divide into three and di nashons kon fall rish groun. So God remember Babilon wey big well-well and E gi-am di cup wey full with en vexnashon wine. 20 All di island and mountins skata finish. 21 Ice-blok wey heavy rish hundred pounds kon dey fall from heaven on-top pipol, but dem still dey curse God, bikos of dia sofa.