19
Party For Heaven
Afta dis tins, I hear wetin bi like many pipol vois for heaven dey sey:
“Halleluya! Make salvashon, glory and pawa
bi awa God own,
bikos en judgement dey true and korrect.
E don ponish dat ashawo
wey spoil di world with en sins,
as e dey sleep with who e nor marry
and God don revensh am for Christ savants wey e kill!”
Den di pipol shaut again, “Halleluya! Di smoke from di fire wey burn am go dey go up forever and ever!” Di twenty-four eldas and di for creatures kon bow and woship God wey sidan for di throne sey, “Amen! Halleluya!”
Den one vois tok from di throne sey: “Wi wey bi God savant, make wi praiz am! All of una wey dey fear am, both small and big, make una praiz am too!”
Di Lamb Marriage
Den I hear many pipol vois wey bi like river and tonda nois dey shaut: “Halleluya! Na awa Oga God wey get all pawa dey rule! Make wi happy well-well kon gi-am glory, bikos di Lamb marriage don rish and di pesin wey E won marry, don ready too.” Dem allow am wear klean linen wey dey shine, (Dis linen mean di good tins wey God pipol do).
Den di angel tell mi, “Rite dis tin wey I won tok naw: ‘God don bless pipol wey en invite kom chop for di Lamb marriage!’ ” E still tell mi sey, “Dis na God true word.” 10 So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”
God Pikin Go Fight War
11 Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war. 12 En eyes bi like fire wey dey burn well-well and many crowns dey en head. Di name wey dem rite for en head, nobody know am, escept en ensef. 13 E wear klot wey dem soak inside blood and di name wey dem dey koll am, na God Word. 14 Di sojas wey dey heaven, wear white linen kon enter white horse dey follow am. 15 One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa. 16 For en klot and lap, wetin dem rite put na: “King and Oga God wey big pass.”
17 Den I si one angel stand for di sun and e shaut give all di bird for sky sey: “Make una kom, make una gada round kom chop for God party. 18 Make una kom chop kings, ofisas, sojas, dia horse, di drivers and human being flesh: weda dem dey free or dem bi slave, big or small pipol, make una kom chop beleful!”
19 Den I si di beast, di kings wey dey di world, dia sojas, as all of dem gada to fight di Pesin wey dey ride di horse and en sojas. 20 So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive. 21 Dem take di swod wey dey kom out from di Pesin wey dey ride di horse mout, kon kill di odas, den all di birds chop dia body till di beleful.