10
Samuel Anoint Saul
Den Samuel take one kontaina wey get olive oil kon pour am for Saul head. Samuel kiss am kon sey, “God don choose yu make yu lead en pipol, Israel! Yu go rule and diliver dem from dia enemies wey dey round dem. Dis go bi di sign sey God don choose yu as leader ova en propaty. Wen yu leave mi today, yu go si two men near Rashel Grave for Benjamin borda wey dey Zelzah. Dem go tell yu, ‘Di donkey dem wey yu dey fine, dem don si dem. Yor papa nor dey worry for di donkey again, but e dey worry for una too. E dey ask sey, “Wetin I go do naw wey I nor si my pikin?” ’
“As yu dey go from here, yu go rish dat tall tree for Tabor. Dat time, three men wey dey go meet God for Bethel, go meet yu. One of dem go karry three bread and one go karry one kontaina wey get wine. Dem go ask yu how yu dey and dem go give yu two bread. Make yu kollect dem.
“Den yu go-go God hill for Gibeah where Filistia pipol ofisas dey. Wen yu enter di town, yu go meet some profets wey dey kom down from di altar for di hill. Dem go karry harps, sheke-sheke, wiso and lyres and dem go dey tok about wetin go happen. Den God Spirit go enter yu and yu go dey profesai as dem dey do. Yu go bi like anoda pesin. Wen dis signs don happen, make yu do anytin wey yu fit do, bikos God go dey with yu.
“Yu go-go Gilgal before mi. I go kom meet yu for der kon offa ofrin and make peace ofrin for der. Yu go wait for seven days, until I go kom tell yu wetin yu go do.”
Saul Na King
As Saul turn leave Samuel dey go, God kon shange as Saul dey tink. All di signs happen for dat same day. 10 Wen dem rish Gibeah, some profets kom meet am. Den God Spirit enter Saul body and e kon bigin tok like di profets. 11 Wen evribody wey know am before si am dey tok like profet, dem kon dey ask each oda, “Wetin dey happen to Kish pikin? Saul sef don bi profet?”
12 One man wey kom from der kon ansa, “Na who bi dia papa?” So dis tin kon turn parabol: “Saul sef dey among di profets?” 13 Wen Saul don tok finish, e kon go di altar for di hill.
14 Saul papa broda kon ask en and en savant, “Na where una go?”
Saul ansa, “Wi go look for di donkey. But wen wi nor si dem, wi kon go meet Samuel.”
15 Saul papa broda kon sey, “Make yu tell mi wetin Samuel tell yu.”
16 Saul ansa am, “E tell us sey dem don si di donkey.” But Saul nor tell am wetin Samuel tell am about to bi Israel pipol king.
17 Den Samuel koll di pipol make dem kom meet God for Mizpa. 18 E tell dem, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok, ‘I bring una kom out from Egypt kon diliver una from dia pawa and from all di kingdoms wey dey opress una. 19 But today, una don rijet di God wey save una from all una trobols and wahala. Una don sey, “No! Choose king wey go rule us.” Naw make una stand for God present akordin to una tribe and family.’ ”
20 Den Samuel bring all di tribe for Israel and dem kon trow dice take choose Benjamin tribe. 21 Den e bring Benjamin tribe akordin to family and na Matri family dem choose. At last, dem kon choose Kish pikin wey en name na Saul wen dem trow di dice. But wen dem look for am, dem nor si am. 22 So dem kon ask God again sey, “Di man don rish here?”
God ansa, “E hide ensef for back of di tins wey dem dey supply.”
23 So dem run go karry am kom from der. Wen e stand with di pipol, e tall pass all of dem. 24 Samuel tell di pipol, “Una don si di pesin wey God don choose? True-true, nobody bi like am for di whole Israel!”
All di pipol kon shaut, “Di king go stay forever!”
25 Samuel tell di pipol how di king go work. E rite evritin down for book kon put am for God present. Den Samuel sey make evribody dey go dia house.
26 Even Saul sef go en house for Gibeah. But some strong men wey God don tosh dia heart, follow am go en house for Gibeah. 27 But some wiked pipol sey, “How dis man go fit take save us?” Dem curse am and dem nor gri kom gi-am gift. But Saul nor tok anytin.