17
David Kill Goliat
Filistia pipol gada dia sojas to go fight. Dem gada for Soko wey dey Judah. Dia kamp dey for Efes-Dammim wey dey between Sokoh and Azeka. Saul and Israel men kamp for Ela Valley where dem for dey ready to go fight Filistia pipol. Filistia pipol stand for one side, while Israel pipol dey di oda side and na di valley separate dem.
Den di champion for Filistia pipol kamp kon kom out. En name na Goliat and e kom from Gat. E tall rish seven fit. E wear bronze helmet for head and e wear iron koat wey heavy rish one hundred and twenty-five pounds. Wetin e take protet en leg na bronze and di spear wey dey en shoulder na bronze too. En spear mout tick well-well and di iron heavy rish fifteen pounds. Di pesin wey dey karry en shield, dey waka for en front.
E stand kon shaut for Israel pipol, “Wetin una dey do for der? Make una kom out kon fight? I bi Filistia pesin and una na Saul savants. Make una choose one of una man make e kon fight mi. If e fight kon win mi, wi go bi una savants. But if I win and kill-am, una go bikom awa savant kon serve us.” 10 Den e kon sey, “I dey shalenge Israel sojas today sey, ‘Make una pick one pesin, make e kon fight mi!’ ” 11 Wen Saul and Israel pipol hear wetin di Filistia man tok, dem vex well-well and fear kon dey katch dem.
12 Naw, David na one Efrat man pikin and di man kom from Betlehem for Judah and en name na Jesse. Di man get eight boys and wen Saul dey rule, di man don old well-well. 13 Jesse three first boys don follow Saul go di war and dia names na, Eliab wey bi di first-born, sekond to Abinadab and Shammah wey bi di third. 14 Na David bi di last born among en papa sons, while di first three shidren dey follow Saul. 15 David dey go kom back from Saul palis, so dat e go fit take kare of en papa sheep for Betlehem.
16 So for forty days, di Filistia man dey kom out evry morning and evening dey shaut.
17 So one day, Jesse kon tell David, “Make yu take dis korn wey dem roast and ten bread go give yor brodas. 18 Den give dia oga dis biscuits. Make yu find out how yor brodas dey, den kom back kon tell mi weda dem get evritin wey I dey send yu go give dem. 19 Dem dey with Saul and Israel men wey won fight Filistia pipol for Ela Valley.”
20 So David get up before day break kon give en papa animal to pesin make e guide dem. Afta e don pak evritin, e kon go just as Jesse tell am. E rish di kamp as di sojas dey go di war front and dem dey sing war song. 21 Israel pipol and Filistia pipol stand opposite each oda and dem dey ready to fight. 22 Afta David don give wetin e karry kom to di pesin wey dey divide tins give di sojas, e kon run go di war front. Wen e rish der, e kon ask en brodas, how una dey? 23 As e dey tok to dem, Goliat di Filistia champion wey kom from Gat kon kom out from Filistia pipol side. E tok as e always dey do and David kon hear am. 24 Wen Israel men si Goliat, dem go hide, bikos of fear.
25 Di men for Israel kon sey, “Yu si dis man wey dey kom out always? E dey do like dis to shalenge all Israel. But awa king don sey, ‘Anybody wey go fit kill di man, e go gi-am money and en dota make e marry and di pesin papa house nor go dey pay tax again.’ ”
26 David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”
27 Di sojas kon tell am wetin di king promise, “Dis na wetin I go do for di man wey go kill Goliat.”
28 Wen en senior broda Eliab hear am dey tok to di men, e kon vex tell David, “Wetin make yu kom der? Na who yu sey make e guide doz sheep for di desert? I know sey yu like to show yorsef! Yu just kom here to wosh di fight!”
29 David ansa am, “Wetin I don do naw? I nor go fit tok anytin again?” 30 Den, David waka komot der kon go ask anoda pesin di same kweshon, but dem gi-am di same ansa. 31 Wen dem hear wetin David tok, dem kon tell Saul. So Saul kon koll David.
32 David tell Saul, “Nor let anybody mind fail am. Yor savant go-go fight dis Filistia man!” 33 But Saul ansa David, “Yu nor go fit fight dis Filistia man, bikos e don tey wen dis man don dey fight and yu still small!”
34 David ansa Saul, “Yor savant dey guide animal for en papa. Wen ever lion or bear or wild animals kon karry one sheep from di odas, 35 I go porshu di animal, nak am fall kon save di sheep from en mout. If e stand up won fight, I go hold en neck, nak and kill-am. 36 Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!” 37 David still sey, “God wey diliver mi from di lion and di bear, go still diliver mi from dis Filistia man hand!”
Den Saul kon tell David, “Make yu go fight am and make God dey with yu.”
38 Den Saul wear wetin e take dey fight put for David body kon put en bronze helmet for en head. E still put iron shirt for en body. 39 David put en swod for di tins wey e wear to go fight and e kon try to waka, but e nor fit waka, bikos e nor dey use dem before.
David kon tell Saul, “I nor fit waka with dis tins, bikos I neva use dem before.” So David kon remove dem. 40 David karry en stik for en hand kon pick five good stone from di stream, den e put dem for en animal bag. E take en katapault kon dey go meet di Filistia man.
41 Di Filistia man with di pesin wey karry en swod kon dey waka kom meet David. 42 Wen di Filistia man near David, e kon vex well-well, bikos na small and fine boy e bi. 43 Di Filistia man tell David, “I bi dog wey yu dey kom meet with stik?” Di Filistia man kon use en juju name take curse David. 44 E tell am, “Kom meet mi, so dat I go give yor flesh to di birds for sky and wild animals for di field, make dem chop.”
45 But David ansa am, “Yu dey kom meet mi with swod, spear and javelin. But I dey kom meet yu with di name of di Oga wey bi God of all ogas; Israel sojas God wey yu dey shalenge. 46 Today, God go give yu to mi. I go kill yu for groun kon kut yor head komot. I go give yor dead body to di bird for di sky and di wild animals for di land. Den all di land go know sey Israel pipol get betta God 47 and evribody for here go know sey nor bi by swod or spear, God dey take save pesin. Bikos na God get di fight and E go give yu to us.”
48 Goliat kon waka dey kom meet David, so dat e go attack am, den David kwik-kwik run go front go attack Goliat. 49 David put en hand inside di bag kon take one stone. E put am for di katapault kon shot di Filistia man for en head. Di stone enter en fore head well-well and e kon fall face groun.
50 David win di Filistia man with di katapault and stone. E shot di Filistia man fall kon kill-am. David nor even get swod for en hand.
51 So e run go stand near di Filistia man kon take en swod take kill-am, den e kut en head komot with di swod.
Wen Filistia pipol si sey dia champion don die, dem kon bigin run. 52 Den di men for Israel and Judah kon bigin sing war song. Dem porshu Filistia pipol go rish di valley and Ekron gate. Di Filistia man dead body dey groun for Shaaraim road wey dem dey pass go Gat and Ekron. 53 Wen Israel sojas kom back, dem kon karry evritin for Filistia pipol kamp. 54 David take Goliat head go Jerusalem and e put Goliat swod for di tent.
55 As Saul dey wosh David dey go fight di Filistia man, e kon ask Abner wey bi di sojas oga sey, “Abner! Na wish pesin pikin bi dis sef?”
Abner ansa, “My king, I nor know.”
56 Di king kon sey, “Make yu go find out wish pesin pikin e bi?”
57 So wen David kom back afta e don kill di Filistia man, Abner kon take am go meet Saul. David still hold Goliat head for en hand.
58 Saul ask am, “My pikin! Na wish pesin pikin yu bi? Who bi yor papa?”
David ansa, “Jesse wey bi yor savant wey kom from Betlehem, naim bi my papa.”