21
David Go Nob
David go meet Ahimelek wey bi Nob priest. Ahimelek dey fear wen e meet David, so e kon tell am, “Wetin make only yu dey waka without bodyguard?”
David kon ansa, “Di king sey make I do sometin and e sey, ‘Nor let anybody know why I dey send yu or tell yu dis tins.’ I don tell my sojas make dem wait for one place. So naw wetin yu get? Make yu give mi five bread or anytin wey yu si.”
Di priest ansa David, “I nor get ordinary bread, na only di holy bread dey and di sojas go fit chop am if dem nor sleep with woman.”
David tell di priest, “True-true, dem nor dey sleep with wimen wen wi dey go war. Dia swods sef dey holy, even doh na ordinary journey wi dey go. So today, dem even dey holy well-well!” So di priest give David di holy bread, bikos no oda bread dey der. Dem take am from God present, so dat dem go put hot ones for der.
One of Saul savant dey der dat day, bikos e nid to do some tins wey God tell am. En name na Doeg wey kom from Edom and na en dey kare for Saul animals.
David ask Ahimelek, “Yu nor get any spear or swod for here? I don forget my own, bikos I dey rush kom here.”
David Go Gat
Di priest ansa, “Goliat, Filistia pipol wey yu kill for Ela Valley, na only en swod wey dem wrap with klot put for di efod back, dey here. If yu wont am, make only yu go take am. Anytin wey pass dat one, nor dey here.”
David kon sey, “Nor-tin good rish dat one! Make yu give mi!”
10 So dat day, David kon run from Saul go meet King Akish for Gat. 11 King Akish savant kon ask di king, “Nor bi David bi dis, David wey bi king for en kountry? Nor bi en pipol dey sing sey,
“ ‘Saul kill 1,000,
but David kill tazon plus tazon.’ ”
12 David tink wetin dem tok for en mind kon dey fear King Akish for Gat. 13 So wen David dey with dem, e bihave like sey e dey mad. Since e dey under dia pawa, e dey do like mad pesin kon dey rite for dia town gate, while spit go dey rush komot en mout.
14 Akish kon tell en savant, “Si dis mad man! Wetin make yu bring am kom meet mi? 15 Di mumu dem wey I get nor plenty rish? Why yu bring dis kraze man kom my front? Yu wont make dis mad man enter my house?”