23
David Diliver Keilah Town
Dem kon tell David, “Filistia pipol dey fight for Keilah and dem dey karry dia tins go.” So David ask God, “Make I go kill all dis Filistia pipol?”
God ansa David, “Make yu go kill Filistia pipol kon diliver Keilah pipol.”
But David men kon tell am, “Wi still dey fear as wi dey here for Judah! How e go kom bi if wi go fight Filistia sojas for Keilah?”
So David ask God again. But God tell am again sey, “Make yu go save Keilah pipol. Bikos I don put Filistia pipol for yor hand.” So David and en men kon go Keilah go fight Filistia pipol. E karry dia animals kon kill dem well-well. Na so David take save Keilah pipol.
David Run From Saul Again
Naw, wen Ahimelek son, Abiatar don run go meet David for Keilah, e karry one efod follow body. Wen dem tell Saul sey David dey Keilah, Saul kon sey, “Today, God don put David for my hand, bikos e don put ensef for tight korna wen e enter town wey get only two gate and big-big iron.” So Saul gada all en sojas, so dat dem go-go katch David and en men for Keilah.
Wen David hear wetin Saul dey plan to do am, e kon tell Abiatar wey bi priest sey, “Make yu bring di efod kom.” 10 Den David sey, “My Oga wey bi Israel God, yor savant don hear sey Saul dey plan to kom distroy di town bikos of mi. 11 Di leaders for Keilah go put mi for en hand? Saul go kom as dem tell mi yor savant? My Oga wey bi Israel God, abeg make Yu tell mi.”
Den God ansa, “E go kom.”
12 David kon ask, “Keilah leaders go give mi and my men to Saul?” God sey, “Dem go give una to am.”
13 So David and en six hundred men kon run komot Keilah; dem kon dey go from one place to anoda. Wen dem tell Saul sey David don run komot Keilah, e nor kon go der again.
14 David kon hide for di hill near Zif desert. Saul dey find David, but God nor let am katch am.
15 David know sey Saul dey find am bikos e won kill-am, so e go stay Horesh for Zif desert. 16 Den Saul pikin Jonatan go meet David for Horesh kon tell am, “God go always guide yu.” 17 E tell am, “Make yu nor fear, bikos my papa hand nor go fit tosh yu at-all. Yu go rule Israel and I go dey by yor side. Even my papa know sey na so e go bi.” 18 Wen di two of dem don make kovenant for God present, David stay for Horesh, but Jonatan kon go house back.
19 Den Zif pipol go tell Saul for Gibeah sey, “David dey hide for Horesh near Hakilah Hill wey dey Jeshimon sout.” 20 Di pipol still sey, “Awa king, wi know how yu really one katch David; so make yu kom awa aria and wi go make sure sey yu katch am.”
21 Saul ansa, “Make God bless una, bikos una don sorry for mi. 22 Make una go make betta plan and know where e really dey and di pesin wey si am. Bikos dem tell mi sey e get sense well-well. 23 Make una take time find di real place wey e dey, den kon tell mi. Den I go follow una go. If e dey di land, I go find am among doz wey dey Judah.”
24 So dem leave Saul kon go back to Zif. Naw, David and en men dey inside Maon desert for Arabah wey dey Jeshimon sout. 25 Saul and en men kon go look for David. But dem tell David, so e kon go stay di rock for Maon desert. Wen Saul hear sey e dey der, e kon porshu David go Maon desert.
26 Saul pass one side for di mountin, while David and en men pass anoda side for di mountin. David dey hurry, so dat Saul nor go katch am, but Saul and en men don surround David and en men well-well. 27 But one pesin run kon tell Saul, “Make yu kwik-kwik kom, bikos Filistia pipol don dey skata di land!” 28 So Saul stop to porshu David and e kon go fight Filistia pipol. So dem kon dey koll dat place Sela Hammahlekot. 29 Den, David komot der kon go stay where strong pass for En-Gedi.