28
Di Witch
Afta some time, Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. So Akish kon tell David, “Hope yu know sey yu and yor men go follow mi go fight.” David ansa, “If na so di kase bi, den yu go know wetin yor savant fit do!” Akish kon sey, “Den I go make yu my bodyguard from naw go.” Naw, Samuel don die and evribody for Israel dey mourn. Dem beri am for en town for Rama. For dis time, Saul don porshu all di majik pipol and doz wey dey si vishon komot di town. Filistia pipol gada kon kamp for Shunem. Saul gada all en sojas for Israel kon kamp for Gilboa. Wen Saul si sey Filistia sojas plenty well-well, e kon dey fear. So Saul pray to God, but God nor gri listin to am. God nor even ansa am for dream or thru profet or Urim.
So Saul kommand en savants, “Make una go find any woman wey dey do majik kom, so dat I go-go ask am wetin go happen.” En savant ansa, “E get one majik woman for Endor.” Saul dress so dat pipol nor go know sey na en den e kon go with two of en men. Wen dem rish where di woman dey for nite, e kon sey, “Abeg, make yu use yor pawa take koll di pesin spirit wey I go tell yu.” Di woman ansa am, “Si! Yu know wetin Saul don do; e don porshu di pipol wey dey si vishon and doz wey dey do majik komot from di land. So why yu dey kom try mi, so dat dem go kill mi?” 10 But Saul kon use God take swear sey, “As long as God dey alive, nor-tin go happen to yu.” 11 So di woman ansa, “Na wish pesin name yu wont make I koll?” Saul ansa, “Na Samuel wey don die.” 12 Wen di woman si Samuel, di woman kon kry well-well sey, “Wetin make yu deceive mi? Yu bi Saul!” 13 Di king ansa, “Nor let fear katch yu. Wetin yu si?” Di woman ansa, “I dey si pesin wey bi like god dey kom out from groun!” 14 Di king ask di woman, “Na how e look like?” Di woman ansa, “Na old man dey kom so-o! Dem wrap en body with klot!” Den Saul know sey na Samuel and e kon bow face groun. 15 Samuel kon tell Saul, “Wetin make yu dey disturb mi? Wetin make yu koll mi kom back?” Saul ansa, “I dey for big wahala! Filistia pipol dey fight mi and God nor dey ansa mi again. E nor dey listin to mi or tok to mi thru profet or dream. So I kon koll yu, so dat yu go tell mi wetin I go do.” 16 Samuel kon sey, “Wetin make yu dey ask mi naw wey God don turn from yu kon bi yor enemy? 17 God dey do wetin E tok. E don tear di kingdom from yor hand kon gi-am to David. 18 Since yu nor gri obey God and yu nor show en vexnashon to doz Amalek pipol, God don ponish yu today. 19 God go give yu and Israel pipol to Filistia pipol. Tumoro, both yu and yor sons go dey with mi. God go still give Israel sojas to Filistia pipol.”
20 Saul kon kwik-kwik sleep for groun for der and e kon dey fear, bikos of wetin Samuel tok. E nor get any pawa to waka again, bikos e nor chop anytin from morning go rish nite. 21 Wen di woman kom meet and si how Saul dey fear rish, di woman kon tell am, “Yor savant don do wetin yu ask am. I risk my life kon do wetin yu tell mi. 22 Naw, na yor turn to listin to yor savant. Make I give yu some bread make yu chop. Wen yu don get pawa again, yu fit dey go.” 23 But Saul sey, “I nor wont chop.” En savants and di woman beg am well-well, so e kon gri with dem. E get up from groun kon sidan for di bed. 24 Di woman kwik-kwik kill di small melu wey e get, take some flower, prepare am kon bake bread wey nor get yist. 25 E gi-am to Saul and en savants and dem kon chop. Den dem go back, dat same nite.