30
David Win Amalek Pipol
For di third day, David and en men kon rish Ziklag. But Amalek pipol attack Negev and Ziklag. Dem burn Ziklag rish groun. Dem katch di wimen wey dey der, from di small ones go rish di old ones, but dem nor kill anybody. Dem just karry dem follow body.
Wen David and en men rish di town, dem kon si sey Amalek pipol don burn am kon karry dia wimen, sons and dotas go. Den David and en men kon kry well-well until dem nor fit kry again. Dem katch David two wifes, Ahinoam wey kom from Jezrel and Abigail from Karmel wey bi Nabal wife before. David vex well-well, bikos en men dey tink for dia mind sey make dem stone am. Each man dey kry for en pikin. But di Oga God kon give David strong mind.
Den David tell priest Abiatar wey bi Ahimelek pikin, “Bring di efod kon give mi.” So Abiatar bring di efod kom. So David ask God, “Make wi porshu dem? Wi go katch dem?”
God ansa, “Make una porshu dem, una go true-true katch dem kon diliver una wifes and shidren.”
So David porshu dem with en six hundred men. Wen David rish River Besor, some of en men kon stay der. 10 David and 400 men kon kontinue to porshu dem and two hundred men wey don taya well-well kon stay for River Besor.
11 Den dem si one Egypt man for di field wey almost dey faint, so dem kon bring am kom meet David. Dem gi-am bread and wota make e chop and drink kon still gi-am 12 some fig wey don dry and two raisin. Dis food kon make am strong well-well, bikos e neva chop food or drink wota for three days and three nites.
13 David kon tell am, “Na who yu bi and where yu from kom?” Di yong man kon ansa, “I kom from Egypt and my oga na Amalek pesin. My oga go leave mi, bikos I dey sick for three days naw. 14 Wi go distroy Keret wey dey Negev for Judah aria and Negev aria wey bi Kaleb own. Wi burn Ziklag.”
15 David kon tell am, “Yu fit take us go where yor pipol dey?”
Di man ansa, “Make yu swear first sey yu nor go kill mi or give mi to my oga, den I go take una go der.”
16 So di man take David go where Amalek pipol dey and David kon si sey dem full di land. Dem dey chop and drink; dey enjoy diasef, bikos of evritin wey dem karry from Filistia pipol and Judah land. 17 But David kill dem from morning until di next evening. Non of dem eskape, escept di 400 men wey enter kamel kon run. 18 David kollect evritin wey Amalek pipol take before; e save en two wifes. 19 Nor-tin lost, weda na small or big tin. E save pipol sons and dotas; di tins wey Amalek pipol take from dem and evry oda tin wey dem take before. David bring evritin kom back. 20 David take all di sheep kon put dem for di oda animals front. Pipol kon dey sey, “Dis na di tins wey David karry!”
21 Naw, David don near di two hundred men wey don taya well-well to follow am go; doz wey dem live for River Besor. Dem kon go meet David and di pipol wey dey with am. Wen David rish where di two hundred men dey, e kon ask dem, “How una body!” 22 But all di wiked men among di ones wey follow David kon sey, “Since dem nor follow us go, wi nor go give dem anytin from di tins wey wi karry so. Make dem take only dia wifes and shidren dey go!”
23 But David sey, “Nor bi so, my brodas! Make una nor do like dis. Si wetin God don give us! E don protet and save us from Amalek pipol wey kom fight against us. 24 Who go listin to una for dis matter? Di tins wey dem give doz wey go fight di war, na di same tin dem go give dis men. Make evribody share am ekwol.” 25 David make dis law and Israel pipol dey obey dis law kon rish today.
26 Wen David go back to Ziklag, e kon send some of di tins wey dem karry, go give di leaders for Judah wey bi en friends sey, “Dis gift na for una, wi take dem from God enemies.”
27 Di gift na for di pipol wey dey: Bethel, Ramot Negev and Jattir; 28 doz wey dey Aroer, Sifmot, Eshtemoa, 29 and Rakal. Doz wey dey Jerahmeel and Ken town; 30 plus Hormah, Bor-Ashan, Atak, 31 Hebron and doz wey dey di oda arias wey David and en men don travel pass before.