3
Di Woman
As I sleep for my bed thru-out di nite,
I find di one I love with my heart and soul,
but I nor si am.
So I tell mysef, “I go get up go di town,
enter di street
kon follow korna-korna go find di pesin wey I love.”
So I find evriwhere, but I nor still si am.
So wen I si di men wey dey guide for nite,
I kon ask dem, “Una si my love?”
As I waka pass dem small,
I kon si di pesin wey I love.
I hold am tight and I nor wont make e go,
so I take am go my mama house;
to di bedroom where e for get my belle.
So Jerusalem wimen,
make una promise mi with gazelle and deer
sey una nor go disturb awa love.
Jerusalem Yong Wimen
Who dey waka kom from di desert like smoke or like incense and myrrh?
Na fine incense wey dem dey sell?
Si! Na Solomon dem karry for en throne dey kom
and na sixty fine sojas for Israel dey guide am.
All of dem sabi use swod well and dem train dem well to fight war.
Each of dem swod dey near dia waist
and dem dey guide against anybody wey won attack dem for nite.
King Solomon use Lebanon wood
take make one chair for ensef.
10 Dem make di korna with silva kon design di back with gold.
Na purpol klot dem take wrap am
and na Jerusalem wimen dekorate am with leda.
11 So Jerusalem wimen,
make una kom si King Solomon dey kom.
E wear di crown wey en mama take crown am
for di day wen e marry and na dat day,
sweet pass for en life.