5
Di Man
I don enter my gardin, my treasure and wife to bi!
I don gada myrrh with spices
and I don chop my honi-komb and my honey;
I don drink my wine and my milk!
Una wey sabi love, make una chop
and drink until love shark una.
Di Woman
I dey sleep, my heart dey dream;
bikos I hear my love dey nok and sey:
“Open for mi, my treasure and darlin;
my dove and di rite pesin for mi,
bikos dew don wet my head and dust don make my hair dirty.”
Di Woman
But I ansa, “I don already pul my klot, make I wear am back again?
I don wosh my leg, make I dirty am again?”
My love try to open di door from outside thru di hole
and I kon dey feel for am.
So, I stand won go open di door for my love,
but perfume and myrrh full my hand
as I dey try to open am.
I open di door for my love, but e don go!
I vex well-well.
I look evriwhere, but I nor si am.
I koll am, but nobody ansa mi.
Di guide dem for nite si mi as dem dey waka dey guide di town wall.
Dem beat, wound and remove di klot wey I take kover my face.
So Jerusalem wimen, make una promise mi sey:
If una si my love, una go help mi tell am sey,
en love don make mi dey sick.
Di Wimen
Woman wey fine well-well,
wetin make yu tink sey yor love betta pass oda men?
Wetin dey good about yor love,
wey go make us promise yu?
Di Woman
10 My love fine well-well and e dey strong;
e betta pass 10,000 pipol!
11 En hair bi like fine gold
and e dey shine like black bird.
12 En eye dey shine like dove wey dey near spring wota;
dem bi like betta gold wey dem wosh with milk.
13 En jaw bi like gardin wey en spices dey scent and
en lip bi like flower wey dem spray myrrh put.
14 En hand round like gold with beryl stone
and en body bi like elefant horn wey dey shine like safaya stone.
15 En leg bi like pila wey dem design with marbol and gold;
while en face bi like cedar for Lebanon.
16 En mout sweet well-well to kiss and evritin about am,
dey sweet mi for body.
So, Jerusalem wimen!
Dis na wetin my love bi like.