4
Samaria wimen, una bi fat melu for Bashan!
Una dey ponish pipol wey nor strong,
wey dey poor and dey opress doz wey dey hongry,
den una go tell una husband,
“Give us more wine make wi drink.”
Bikos God dey holy, E don promise sey,
“Di day dey kom wen dem go karry all of una
go for inside basket like fish wey hook katch.
Dem go drag una kom out from di small hole
wey dey una wall kon karry una go Harmon land.”
Na so Oga God tok.
Israel Pipol Nor Agri Learn
God sey,
“Afta una, Israel pipol don go Bethel
go sin for di holy place and woship juju for Gilgal,
una go kon sakrifice animals for morning,
den for evry three days,
una go bring one out of evry ten tins wey una get kom.
Bread wey dem make with yist,
una dey bring am as ofrin to take tank mi
and dey karry body up bikos of di oda ofrins wey una give.
True-true, dis na di kind tin wey una like to do.”
God sey, “Na mi make hongry dey una town,
but una nor still gri turn kom meet mi.
Na mi stop di rain to fall for una land three monts
before una go harvest wetin una plant.
Sometaims, I dey let rain fall for one town or field
and di oda town go dry well-well
bikos I nor allow rain fall for der.
So pipol dey stagga from one town go anoda town
go look for wota wey dem go drink,
but dem nor si enough wota drink and with all dis tins,
una nor still gri turn from sin kom meet mi.”
Na so Oga God tok.
“I send hot breeze kon dry all wetin una plant.
Ant chop all wetin una plant for una vineyard,
even una fig and olive tree too.
Yet una nor still gri turn kom meet mi.”
Na Oga God dey tok so.
10 “I send diziz kom meet una
like di one wey happen to Egypt pipol.
I kill una yong men for war
kon skata una horse.
I allow dead body dey smell for una kamps,
but una nor still gri turn kom meet mi.”
Na so Oga God tok.
11 “I distroy some of una town,
just as I distroy Sodom and Gomorrah.
And una wey remain bi like stik
wey dey burn before dem komot am from fire.
With all dis one,
una still nor gri turn kom meet mi.”
Na so Oga God tok.
12 Naw, Israel pipol, mi God go ponish una,
so make una dey ready to face my judgement!
13 “Na mi God kreate di mountins and breeze.
I allow human being know wetin I dey tink.
Na mi dey bring darkness to take kover lite
and I dey waka on-top di hill.
Na mi bi God and na mi get all di pawa.”