5
Turn Kom Meet God
Israel pipol, make una listin to dis sorrowful song wey I dey sing give una:
“Israel town wey ‘neva sin wons’
don fall and e nor go fit raiz again!
E just dey groun like dat
and nobody gri help am.”
God wey get pawa sey,
“One town for Israel send 1,000 sojas go fight,
but na only hundred pipol kom back;
anoda town send hundred,
but na ten kom back.”
God tell Israel,
“Make una kom back kom meet mi
and una nor go die.
Make una nor go Beersheba go woship.
Make una nor find mi go Bethel,
bikos Bethel nor mean anytin again.
Make una nor go Gilgal,
bikos dem go soon karry en pipol
as slave go anoda land
and Bethel go turn empty land.”
So, make una go meet God
and una nor go die.
If una nor go meet am,
E go kom on-top una like fire.
Di fire go burn Bethel pipol
and nobody go fit kwensh am or save una.
Israel pipol dey turn bitter judgement to bad one,
dem dey trowey wetin dey good and korrect for groun!
But e get one Pesin wey make di stars,
Pleiades and Orion.
E turn darkness to lite
kon turn day to nite.
E koll wota from sea
kon pour am put for di eart.
En name na God.
E distroy strong pipol
and di pawa wey dem feel sey dem get.
10 Una nor like anybody wey dey judge well
or tok trut for kourt.
11 So, since una dey opress and tif from poor pipol,
una nor go stay for di fine house wey una build
or drink wine from di fine vine wey una plant.
12 Una sin and all di bad-bad tins wey una do,
I know as dem bad rish.
Una ponish good pipol; dey take bribe
and nor allow poor pipol get korrect judgement for kourt.
13 So, to keep kwayet for dis kind evil time,
naim bi di best tin to do!
14 Make to do good dey sweet una,
nor bi wetin dey bad,
so dat una go get life.
Den Oga God wey get pawa go really dey with una,
just as una tok.
15 Make una hate bad tins
kon love to do good,
den dey judge well for kourt.
May bi God go sorry for di pipol
wey still remain for dis land.
16 So God wey get pawa sey,
“For di town, pipol go dey kry and mourn for evriwhere.
Dem go sey make farmers kry for dia land,
den dem go pay pipol wey go kom mourn with dem.
17 Na so-so kry pipol go dey kry for evry vineyards.
All dis go happen, bikos I dey kom ponish una.”
God wey get pawa don tok.
Make Una Judge Well
18 E go bad well-well for una wey dey wait for God day!
Wetin make una dey wait for dat day to kom?
Instead make di day bring lite,
na darkness go kom.
19 E go bi like pesin wey run hide bikos of lion,
but where e hide put or run enter,
na tiga e go meet for der!
Or like pesin wey run go hide for house,
but as e put en hand for wall,
snake kon bite am!
20 Instead make God day bring lite,
na darkness go follow am kom.
Dat day nor go good at-all,
bikos e go dark well-well.
21 God sey,
“I hate di juju feast wey una dey do;
I nor fit bear dem!
22 Wen una bring korn and burnt ofrin kom give mi,
I nor go asept am;
I nor go asept di animals
wey una kill kon offa give mi as ofrin.
23 Make una stop to make nois sey una dey sing;
I nor won listin to una harp wey una dey play.
24 Instead, make korrect judgement dey rush like river,
while raitiousness go bi like river wey nor dey dry.
25 Israel pipol, I nor ask una for sakrifice and ofrin
for doz forty years wey I lead una pass desert.
26 But naw, bikos una don woship Sikkut image,
wey bi una king god and Kiyyun wey bi una star god,
una go karry dem
27 follow body wen I take una as slaves
go anoda land wey far pass Damaskus.”
Oga God wey dey mighty don tok.