6
Israel Go Skata
E go bad well-well for una wey dey enjoy life for Zion
and una wey feel sey una dey save for Samaria.
Una tink sey na una strong pass,
bikos Israel pipol dey respet and koll una to kom help dem.
Make una go si wetin happen to Kalneh land,
den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat.
Una nor si as dem distroy dem,
abi una betta pass dem?
Una nor won gri sey wahala dey kom
and wetin una dey do, go make am kwik kom.
E go bad well-well for una
wey dey relax for una big fine chair
kon dey chop betta meat!
Una dey sing difren songs and dey play harp,
just as David bin dey do.
Una dey drink wine from di basin
wey una dey use for sakrifice
and dey spray betta perfume for body,
but una nor kare about Israel land wey don skata.
So, na una dem go first katch as slave.
And all di food, drink and party wey una dey do,
go end.
Oga God wey get pawa don warn una well-well sey,
“I hate as Israel pipol proud rish;
I hate di strong and big-big house wey dem get.
I go give dia main town and evritin wey dey inside,
to dia enemies.
If na ten men remain for one family,
all of dem go die finish.
10 Wen dia rilashons;
di pipol wey go burn di dead body go kom
karry di body komot from di house,
dem go ask di pesin wey dey di house sey,
‘E get any oda pesin wey dey here with yu?’
Di pesin go ansa, ‘No!’
Den di rilashons go sey, ‘Kwayet!
Make yu nor just menshon God name.’ ”
11 True-true, make una si!
Wen God kommand,
both big and small house go skata to pieces.
12 Horse fit run well on-top rock?
Abi human being fit ride horse on-top wota?
Yet, una don turn bitter judgement to poizin
and good to bad.
13 Una dey boast sey una seize Lo-Debar town and una sey,
“Nor bi wi win and katch Karnaim town with awa own pawa?”
14 Oga God wey get pawa sey,
“Israel pipol, make una si!
I go send sojas kom distroy una kountry
and dem go opress una from Lebo-Hamat for nort
go rish Arabah River wey dey sout.”