5
New Body
Wi know sey if dis awa house for eart, wey bi awa body skata, God get di one wey wi go stay, wey e bi sey nor bi human being hand build am and e go last forever for heaven. Bikos for dis awa house for eart, wi dey struggol, bikos wi nor fit wait to wear awa new body for heaven. Afta wi don wear awa new body for heaven, wi nor go dey naked again. Wi dey struggol as wi dey dis awa body. Wi dey karry heavy load, bikos wi nor won remove di klot wey bi awa body, but wi won wear heaven own join am, so dat life go swallow dis awa body wey fit die. Naw, di Pesin wey prepare us for dis tins, na God wey give us di Spirit, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E get for us. So, wi dey always get mind and wi know sey, as long as wi dey alive for dis eart, wi nor dey where God dey, bikos wi dey live awa life with faith, nor bi with wetin wi dey si. So wi dey always get di mind sey wi go die komot from dis world, so dat wi go-go stay with Jesus Christ for where e dey. So, weda wi dey alive or wi don die, wi dey do evritin wey wi fit do to make Christ happy. 10 Bikos all of us must stand for Christ front and e go judge us akordin to di tins wey wi do wen wi dey dis eart; weda dem good or bad.
Salvashon Message
11 So, bikos wi know wetin e mean to fear God, naim make us dey prish and beg pipol. But God know us well-well and I hope sey una know us well-well for una mind too. 12 Wi nor dey try to tok make una for sey wi dey good, but wi dey give una shance to boast, so dat una go fit ansa pipol wey dey boast with wetin eye fit si, but nor bi wetin dey dia mind. 13 If wi dey kraze, na bikos of God; but if wi nor dey kraze, na bikos of una. 14 Bikos na Christ love dey kontrol us since wi know sey, Christ die for evribody; so evribody don die. 15 And e die for evribody, so dat evribody wey dey live nor go live for diasef again, but for di Pesin wey die and wake-up afta three days. 16 So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again. 17 So, if any man dey inside Christ, e don dey new, Christ don klean di bad tins wey e do before and evritin don turn to new one! 18 All dis tins dey kom from God wey make us en friends bikos of Christ and E still give us di ministry wey go make pipol bi en friend. 19 So, bikos of Christ, God dey turn di world from en enemy, to en friend. E nor dey kount pipol sins against dem and E don give us di message wey go make pipol bi en friend. 20 Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!” 21 Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.