6
God Savants Wey Dey Sofa
Naw, bikos wi bi fellow workers, wi dey beg una make una nor waste God grace wey una don receive. Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon! Wi nor dey do anytin wey go make anybody vex, so dat nobody go si any fault for awa work. But wi dey show sey wi bi God savant for evritin wey wi dey do. Wi dey sofa well-well and face trobol for dis time; even for wiked times; for di time wey dem dey beat us and put us for prison; for di time wey dem dey fight; for wahala time; for nite wey wi nor fit sleep and for hongry time. Wi dey do all dis tins with awa klean life, di tins wey wi know; di patient wey wi get; di good wey wi dey do for pipol; di Holy Spirit wey wi get; betta love wey wi show pipol; thru di word wey wi dey tish with God pawa; with wetin wi take dey defend awa raitiousness both for awa rite and left hand; for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut. Dat time, e bi like sey nobody know us, but evribody know us; e bi like sey wi don die, but wi dey alive; wi still dey alive like pipol wey dem dey ponish, but dem nor fit kill us; 10 wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin.
11 So, una wey bi Korint pipol, wi don open awa heart tell una evritin. 12 Wi nor dey whole awa love from una, but na una dey whole una love from us. 13 So make wi make am ekwol. I dey tok to una like sey una bi my shidren, so make una open una heart for us too.
Una And Dem Nor Bi Di Same
14 Make una nor make friend with pipol wey nor bilive, bikos, na wish kind friend raitiousness and bad tin won bi, or na wetin lite and darkness get togeda? 15 And na wish kind agriment Christ and devil get? Wetin koncern pesin wey bilive and pesin wey nor bilive? 16 Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.” 17 Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una 18 kon bi una Papa and una go bi my shidren.” Na so God wey get all di pawa, tok.