8
Pipol Wey Dey Save
Awa brodas and sistas, wi don tell una about di grace wey God give di pipol for di church for Masidonia sey, even wen dia sofa strong well-well; dem still dey happy and wen dem nor get money at-all; dem still dey fine money give us. I bi witness sey dem dey give akordin to wetin dem get. Sometaim, dem dey give pass wetin dem get. Nobody dey force dem to do like dat, but dem dey do am from dia own mind and dem dey beg us make wi let dem do am, so dat dem go get di blessing wey dey follow pipol wey dey give. Dem dey do like dis, nor bi only as wi wont am, but na bikos dem don first give demsef to God, den dem kon give demsef to us as God wont. Na dis make us beg Titus sey, as e don start, e good make e finish dis good work wey e dey do, bikos e love una. But as una dey do well for evritin: For faith; for tok; for wetin una know and as una won do di work well, bikos una love us, make una make sure sey una dey do dis good with all una heart. Nor bi sey I dey kommand una, but I won si weda una love na really won like di oda church pipol own. Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish. 10 Na wetin I tink for di matter bi dis: Una start well last year for how una dey give and how una dey won give, 11 so e betta make una just finish wetin una start, so dat di way wey una take start, na so too una go still take finish am as una pawa rish. 12 Bikos if e really dey una mind to do am, anytin wey una give akordin to wetin una get, God go asept am, but nor bi wetin una nor get. 13 I nor dey tok dis one, so dat wen una don give oda pipol, dem go kon get and una go kon dey sofa, but na to make sure sey tins dey ekwol. 14 As tins bi naw, di money wey una get go help dem as dem nor get, so dat one day, di money wey dem go get go still help una wen una nor get, dat time evritin go kon dey ekwol, bikos 15 dem rite for God word sey: “Di pesin wey gada plenty, nor go get plenty and di pesin wey gada small, go get di one wey go rish am.”
Titus Mission
16 Wi tank God wey give Titus di kind mind wey I get to help una. 17 Bikos e nor only gri for wetin wi ask am, but e dey help una well-well and nobody force am kom meet una. 18 And di broda wey all di church dem dey praiz, bikos of how e dey prish di gospel, wi dey send am follow Titus too and 19 bikos of di work wey di broda dey do, di church don choose am as di pesin wey go dey follow us travel as wi dey give dis good gift, so dat all di glory go bi God own and dis go show sey wi dey ready to help. 20 Wi dey do like dis, so dat nobody go komplain as wi dey share dis gift. 21 Bikos wi dey try to do wetin dey rite, nor bi only for God eye, but for pipol eye too. 22 So wi dey send awa broda follow dem; awa broda wey wi don test plenty times kon si sey e get di mind to help and e ready to help naw, bikos e trust una well-well. 23 But for Titus, en na my patina and e dey follow mi work to help una. As for di oda brodas wey dey follow am, na all di church sey make dem kom meet una, so dat dem go tell una about di glory wey dey inside Christ. 24 So make una show dem sey, una love dem, so dat all di pipol for di church go know sey, di way wey wi dey boast about una, na true.