7
Leta Wey Kause Pain
So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God. Make una allow di gospel enter una heart bikos wi nor do bad to anybody or fall anybody business or play anybody wayo. I nor dey tok dis one to kondemn una, bikos I don tell una before sey, una dey awa mind and wi with una go die and live togeda with Christ.
Di Leta Wey Make Pipol Vex
For inside all dis sofa wey wi dey sofa, I still trust and dey boast well-well about una, bikos I get mind for una and my happiness full dey trowey. Even wen wi enter Masidonia, wi nor rest at-all, but dem trobol us from difren korna; wahala for outside, fear for inside. But God wey dey help pipol wey nor happy, naim kon help us wen Titus kom. Wi kon dey happy, nor bi only sey Titus kom, but bikos of di advise wey una gi-am, bikos e tell us how una won si mi; how una dey vex and worry for mi and my happiness kon pass as e bi before. Bikos even if I make una vex with my leta, e nor pain mi sey I rite am (even doh e pain mi as I know sey e make una vex, aldo una vexnashon nor tey). Naw I dey happy, nor bi bikos una dey vex, but bikos una vexnashon make una turn from sin kom meet God. Na so God plan una vexnashon, so dat bad tins nor go happen to una bikos of dis vexnashon wey wi kause for una. 10 Bikos wen God make pipol sorry for di sin wey dem kommit, dem go turn kom meet am, den God go save dem and dem nor go regret again. But di vexnashon wey dis world dey bring, na deat dey end am. 11 Naw, make una si wetin dis vexnashon wey God plan don do for una: Si how una work for God bi naw; si how una won show sey una hand klean; si as una dey vex bikos of di bad tin wey happen; si how una dey sopraiz; si as una dey won si and worry about us; si how una ready to ponish anybody wey do bad! For evritin, una don show sey una hand klean for dis matter. 12 I nor rite dis leta give una bikos of di pesin wey do bad or di pesin wey dem do di bad to, but na to show una how una won work for God bikos of us. 13 So, Christ don make awa mind strong. Even as awa heart don strong rish, wi dey happy more-more for Titus wey kom, bikos all of una don let en mind rest. 14 I don boast gi-am about una and una nor let mi shame, but as evritin wey wi tell una na true, na so all di boast wey wi boast about una give Titus, na trut too. 15 And wen e remember how una obey and welkom am with respet and fear, di love wey e get for una, kon strong well-well. 16 Evritin dey make mi happy, bikos di trust wey I trust una, nor dey shake.