11
Israel Leaders Judgement
God Spirit kon karry mi go di east gate for di temple. For near di gate, I kon si twenty-five men, plus Jaazanaya, wey Azzur born and Pelataya wey bi Benaya pikin and di two of dem na leaders for di land. So God tell mi, “Dis men dey plan evil and na wiked advise dem dey give Jerusalem pipol. Dem sey, ‘E neva rish wen wi go ribuild awa house. Di town bi like pot and na wi bi di meat wey dey inside di pot, but at least di fire nor dey tosh or burn us.’ So, Man pikin, go tok against wetin dem dey do.”
God Spirit kon dey kontrol mi and E give mi message make I go tell Israel pipol sey: “I know wetin una dey tok and wetin una dey plan to do. Una don kill many pipol for dis town, sotey dead body don full evriwhere for di street. So dis na wetin mi God dey tell una. ‘I gri sey di town na pot and na pipol wey una kill bi di meat! So, una nor go stay here again, bikos I go remove una from di town! Shebi una dey fear swod? So, I go fight una with men wey karry swods. I go take una komot di town kon give una to strenjas. Yes! I go judge una 10 and una go die wen una dey fight war for una kountry. Den evribody go know sey na mi bi God. 11 Dis town nor go bi pot for una again and una nor go bi meat inside am. So, anywhere wey una dey for Israel, I go judge and ponish una. 12 Den una go know sey na mi bi God! Una dey keep oda nashon law, but una dey break my own and nor dey obey my kommand.’ ”
13 As I still dey tok, Pelataya wey bi Benaya pikin, kon fall die. I fall face groun kon shaut, “God wey get pawa well-well, nor bi so o-o! Yu won kill evribody wey remain for Israel?”
14 God kon tell mi: 15 “Man pikin, di pipol where dey Jerusalem dey tok about yu and di odas wey dey for strenjas land. Dem dey sey, ‘Doz wey dey dem karry go Babilon nor go fit woship God, bikos of where dem dey. So God don give us di land.’
16 “Naw, make yu tell doz wey dey with yu wetin I dey tok so. Na mi send dem go stay for strenj land kon skata dem for evriwhere. Yes, I go still dey with dem for di land wey dem dey.
17 “So, make yu tell dem wetin mi wey bi God dey tok. I go gada dem kom back from di land where I skata dem go kon give dem Israel land again.
18 “Wen dem kom back, dem must skata all di rubbish tins wey dem dey do before kon skata any juju wey dem si for der. 19 I go give dem new heart and mind. I go komot dia sturbon heart wey bi like stone kon put anoda heart wey dey gentol and dey obey. 20 Dat time, dem go keep my law and obey my kommand with all dia heart. Dem go bi my pipol and I go bi dia God. 21 But pipol wey still like to woship juju and do bad tins, I go ponish dem. I go ponish dem for di tins wey dem don do.”
God wey get pawa well-well don tok.
22 Di creatures kon dey fly and di wheel follow dem too. 23 God glory kon komot di town go di east side for di mountin. 24 Leta, God Spirit karry mi go meet di odas for Babilon.
Den di vishon kon finish 25 and I tell di pipol evritin wey God don show mi.