12
Di Profets For Babilon
God kon tell mi. “Man pikin, na where sturbon pipol der yu dey stay. Dem get eye, but dem nor dey si; dem get ear, but dem nor der hear, bikos dem sturbon well-well.
“So man pikin, make yu pak yor load like sey yu dey komot di town. For aftanoon wen pipol still dey look, pritend like sey yu dey go Babilon. Komot from where yu dey kon go anoda place. May bi dia mind go tell dem wetin dey happen, even doh dem sturbon well-well. For aftanoon wen dem still dey look yu, karry di tins wey yu pak like sey yu dey go Babilon. Wen dem still dey look yu, komot der for evening like sey yu dey go anoda place. Break di wall open as dem dey look yu kon trow yor load pass am. As dem still dey look yu, karry yor load for shoulder, den make yu waka enter darkness. Yu must kover yor face, so dat yu nor go si di land and dis go bi warnin to Israel pipol.”
So, I do as God kommand mi. For day time wen dem dey look mi, I pak my load kon karry am like sey I dey go Babilon and for evening, I break di wall with my hand. Den I go out for nite kon karry my load for shoulder and dem still dey look mi.
For morning, God kon tell mi: “Man pikin, naw wey dem don dey ask yu wetin yu dey do, 10 make yu tell dem wetin mi wey bi God tell yu. ‘Dis message na for di priest wey dey rule for Jerusalem and for all di pipol wey dey stay der.’ 11 Tell dem sey, ‘I bi warnin to una. Just as I don do, na so too God go do una. Dem go katch and karry una go Babilon as slaves.’
12 “Di priest among una go karry en load put for shoulder kon waka enter darkness. E go break di wall where e go trow en load pass. E go kover en face, so dat e nor go si di land with en eye. 13 Den I go trow my net on-top am kon katch am with my trap. I go take am go Babilon wey bi Kaldea pipol land (but e nor go si am) and na der e go for die. 14 So I go skata en ofisas and sojas go difren place and mi God go katch and kill dem.
15 “Wen I don skata dem among di nashons and for strenja land, den dem go know sey na mi bi God. 16 But I go let some of dem survive di war, honga and diziz, so dat dem go tell di nashon where dem dey stay naw, about all di yeye tins wey dem do. Den, dem go know sey na mi bi God.”
17 God still tell mi sey: 18 “Man pikin, kry as yu dey chop yor food. Dey shake as yu dey drink wota. 19 Den make yu tell di pipol for di land sey, ‘Dis na wetin God tok about una wey dey stay for Jerusalem and Israel. Una go chop una bread with pain kon drink wota with fear. Bikos of di wahala wey una kause, I go take evritin wey dey una land. 20 Pipol wey dey stay der go sofa and di land go skata finish. Den, una go know sey na mi bi God.’ ”
21 Den God tell mi: 22 “Man pikin, wetin make Israel pipol dey always tok like dis: ‘Di days dey pass dey go, yet all dis vishons nor mean anytin to dem?’ 23 So make yu tell dem sey: ‘Dis na wetin God wey get pawa tok: I go stop all di word wey di pipol dey tok and dem nor go tok like dis for Israel again.’ But make yu tell dem, ‘Di day don rish wen evry vishon wey dem tok, go happen. 24 Bikos dat time, di yeye vishon or words wey Israel pipol dey tok, nor go dey again. 25 Bikos mi wey bi God go tok anytin wey I like and e go happen, just as I tok am: E nor go waste time again and na wen wiked pipol still dey alive. Yes! I go tok di word and e go happen just as I tok am.’ ”
26 Den God tell mi: 27 “Man pikin, Israel house dey sey, ‘Di vishon wey God dey tell us nor go happen naw; E dey tok about tin wey go happen tumoro.’ 28 So make yu tell dem, ‘Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Evritin wey I tok, nor go tey before dem go happen! Evry word wey I tok, go must happen.’ ”