14
God Kondemn Juju
Some leaders for Israel kom meet and ask mi sey, “Wetin God wont?” So God tell mi: “Man pikin, dis pipol don give dia heart to juju and na di juju dey make dem sin. Dem tink sey I go ansa dem? Naw, go tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell dem: Israel pipol dey serve juju and dis juju don make dem dey sin; so if dem go ask any profet kweshon, na mi God go give dem di kind ansa wey good for dia many juju! All dis juju don make Israel pipol turn from mi, but afta I don ansa dem, I bilive sey dem go turn back kom meet mi.
“Naw, make yu tell Israel pipol wetin mi God wey get pawa dey tok: Make una turn back from una juju and from di yeye life wey una dey live. Wen ever any Israel pesin or strenja for Israel turn leave mi kon go serve juju, den e go ask profet kweshon, na mi wey bi God, go ansa am! I go oppoz am. I go use am make ezample for odas. I go komot am from among my pipol. Den una go know sey na mi bi God.
“If any profet give una wrong massage, make una know sey na mi wey bi God do am like dat. But I go still rijet and remove am from among my pipol for Israel. 10 Both di profet and di pipol wey ask am kweshon, na di same ponishment I go give dem too. 11 I go do like dis, so dat Israel pipol go obey and dem nor go turn from mi. Dem suppose bi my pipol and I go bi dia God.”
God wey get pawa don tok.
Noah, Daniel And Job
12 Den, God kon tell mi: 13 “Man pikin, if one kountry sin kon disobey mi, I go stop to give dem food chop. I go send betta honga go der kon kill both animal and human being. 14 Even if Noah, Daniel and Job dey stay der, dia good wey dem dey do, go save only dia own life.”
God wey get pawa don tok.
15 “Or I fit send wiked animal make e kom kill di pipol, den evribody go dey fear di land; nobody go fit travel pass am 16 and even if Noah, Daniel and Job dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren. Dem go save only dia life and di land go bi like wildaness.
17 “Or I fit send war kom dat kountry and dem go distroy di pipol and dia animals with gun, swods and knife 18 and even if doz three men dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren, na only dia own life dem go save.
19 “If I send betta diziz go dat kountry kon kill many pipol and animals, bikos I dey vex 20 even if Noah, Daniel and Job dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren, di betta tins wey dem do, go only save dia own life.”
21 Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals. 22 Yet some pipol go survive for di town, both sons and dotas and dem go karry dem as prisonas go Babilon and wen yu si as dem sin rish, yu go know why I do all dis tins. 23 Yu go si di real rizin why I dey do wetin I dey do.”
God wey get pawa don tok.