15
Di Vine Parabol
Den, God kon tell mi: “Man pikin, na how dem won take kompare vine with tree for forest? Yu fit use di vine do anytin? Yu fit even hang sometin on-top am? E only dey yuzful as firewood. Even if di wood nor burn skata finish for di fire, yu still fit use am do anytin? E nor bin dey yuzful even before dem burn am, so na naw wey fire don burn am, e won dey yuzful?”
Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Just as dem dey take vine for forest kon go burn am, na so I go take distroy and ponish Jerusalem pipol. Dem don eskape one fire, but naw, betta fire go burn dem finish. Wen I don ponish dem, den una go know sey na mi bi God. Dem nor dey respet mi, so I go turn dia land to desert.”
God wey get pawa don tok.