31
Egypt Bi Like Cedar Tree
For di elevent year afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di third mont, God kon tell mi: “Man pikin, go tell Egypt king and all en pipol sey:
“ ‘Wetin I feel sey una resemble
bikos una get pawa?
Una bi like cedar tree for Lebanon
wey get betta shape,
fine-fine branches
and wey tall rish di kloud.
Di tree dey get enough wota
wey go help am grow well-well
and wota dey flow from der
go wota di oda trees for di forest.
Bikos dem wota am well-well,
e kon grow and tall pass any oda tree;
en branches long and tick well-well.
Difren birds dey build dia house for der
and wild animals dey born for under di tree.
All di kountries for di world
dey rest under en shadow.
Make una si as di tree fine rish!
E tall and en branches dey strong
more-more as dem dey grow.
En rut long rish di river bottom.
No cedar or tree for God gardin
fine rish am.
No tree don ever get en kind branches before.
Na mi make am fine like dat
with big-big branches.
Evry tree for Eden wey bi God gardin,
dey jealous am.
10 “ ‘Naw, mi wey bi God wey get pawa, go tell yu wetin go happen to dis tree wey grow rish di kloud. As e dey grow dey tall, na so en pride dey grow too; 11 so I don rijet am and I go let strenjas rule am. Dem go give di tree wetin e deserve, bikos of en wikedness. 12 Sojas from one wiked kountry go kut am down kon leave am der make e die. En branches wey don break go fall on-top all di mountins and valley for di kountry. All di kountries wey bin dey stay under am, go run leave am. 13 Birds go land on-top di tree for groun and wild animals go waka pass en branches. 14 So from naw go, no matter how dem wota any tree rish, e nor go grow kon tall rish di kloud again. All of dem must die like man pikin, dem must die go where dead body dey.’ ”
15 “Dis na wetin God wey get pawa dey tok: ‘Di day wey di tree go die, I go kover am with wota and pipol go kry for am. I go stop en wota and river nor go flow again. Bikos di tree don die, I go let darkness kover Mount Lebanon and all di trees for di forest go dry finish. 16 Wen I send am go where dead body dey, nois wey e go make wen e fall, go shake di whole world. All di trees for Eden and di betta wota for Lebanon wey dey under di world, go happy wen e fall. 17 En friends go follow am die kon go join doz ones wey don already fall. And all of dem wey dey stay under en shadow, go skata go evriwhere. 18 Na Egypt king and en pipol bi di tree. E get any tree for Eden wey tall and fine like una? But naw, like di trees for Eden, una go die kon join wiked pipol and doz wey dem kill for war.
Dis na wetin Oga God tok.’ ”