32
Egypt King Bi Like Krokrodie
Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di twelft mont, God kon tell mi. “Man pikin, go warn Egypt king. Tell am dis message wey I dey give yu:
“ ‘Yu bi lion among di nashons,
but na ordinary animal yu bi for sea;
Yu dey skata di wota with yor leg
kon make di river dirty.
Wen many kountries gada,
na der I go for katch yu with my net
kon drag yu kom dry land.
I go trow yu for groun
make all di birds and animals for di world
chop yu finish.
I go spread yor rotin flesh
for di mountins and valleys.
I go pour yor blood from groun
go rish on-top di mountin
and blood go full di valley.
Wen I don distroy yu,
I go kover di sky kon komot di stars.
Di sun go hide for di kloud back
and di moon nor go shine again.
I go off all di lite for heaven
kon kover di world with darkness.’ ”
Mi, God wey get pawa, don tok.
“Di kountries wey yu neva hear of before,
wen I tell dem how I take distroy yu,
fear go katch dem.
10 Wetin I do yu go make many kountries dey fear
and dia kings go dey shake with fear
bikos of yor kondishon.
For di day wey yu go fall,
all of dem go dey fear for dia own life.”
11 God wey get pawa kon tell Egypt king sey, “Babilon king go kom fight yu.
12 “I go let sojas from kountries wey get pawa,
kill yor men for war.
Dem go distroy all yor pipol
and evritin wey dey make
yu karry body up.
13 I go distroy all yor animals
near where wota dey
and nobody or animals go disturb di wota again.
14 Den I go make di wota kwayet again
kon make di sea flow like oil.”
Mi, God wey get pawa, don tok.
15 “Wen I don make Egypt land empty
and distroy evritin wey dey der,
den una go know sey na mi bi God.
16 Dis warnin wey I dey give dem naw so,
go turn to sorrowful song Leta.
Di wimen go sing di song
as dem dey mourn for Egypt and en pipol.”
Mi, God wey get pawa, don tok.
Dead Body Place
17 For di Fifteent day for di first mont for di twelft year, God kon tell mi: 18 “Man pikin, kry for Egypt pipol. Send dem with di oda kountries wey get pawa go where dead body dey. 19 Tell dem sey, ‘Who una tink sey una fine pass? Una go-go where dead body dey kon follow wiked pipol stay der.’ 20 Egypt pipol go fall with doz wey die for war. Yes! One swod dey ready to kill all of dem. 21 Pipol wey dey strong for dis life before dem die and doz wey fight for Egypt before, go welkom Egypt pipol wen dem kom where dead body dey. Dem go shaut: ‘Wiked pipol wey dem kill for war don kom relax for here!’
22 “Assyria pipol dey der with all en sojas grave. All of dem die for war 23 and dia grave dey for where deep pass. All Assyria sojas die for war and dia grave dey round en grave. But before wen dem dey alive, dem dey make pipol fear.
24 “Elam dey der and all en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die go where dead body. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame. 25 Among doz wey don die, dem make somewhere for Elam and en pipol. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
26 “Meshak and Tubal dey der too and en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame. 27 Dem nor beri dem as dem bin dey beri pipol wey really fight and die for dia kountries; pipol wey dem beri with dia swod under dia head and dia shield for dia body. Dis pipol dey make pipol fear wen dem dey alive.
28 “But naw, dem go win una and una go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.
29 “Edom dey der with en kings and rulers. Dem bi sojas wey get pawa, but naw, dem don die kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.
30 “All di prince for nort plus Sidon pipol dey der too. Even with all di pawa wey dey make pipol fear before, dem still die with shame kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”
31 God wey get pawa sey, “Wen Egypt king and en sojas go si doz wey dem kill for war, belle go sweet dem small. 32 Aldo, na mi worry Egypt king wen e dey alive, so en and en sojas go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”
God wey get pawa don tok.