34
Fake Shepad For Israel
God kon tell mi. “Man pikin, go tok against di leaders for Israel. Tell dem sey mi wey bi God sey: ‘Una wey dey kare for Israel pipol, una own don finish! Una guide unasef kon leave Israel pipol on dia own. Una drink milk kon wear klot wey dem make with wool, den una kill and chop di sheep wey fine pass. But una nor gri kare for una pipol. Una nor gri kare for di ones wey dey weak; heal di ones wey dey sick; bandage di sore wey some get; go find di ones wey waka anyhow or look for di ones wey lost. Instead, una dey trit dem with wikedness. Bikos di sheep nor get shepad, dem kon skata for evriwhere and wiked animal kon dey kill and chop dem. So my sheep kon dey waka anyhow on-top di hills and mountins. Dem skata for evriwhere for di eart and nobody dey to guide or look for dem.
“ ‘Naw, una wey bi shepad, make una listin to wetin mi, God dey tell una. As long as I bi di God wey nor dey die, e go betta for una if una listin to mi. Wiked animals attack my sheep kon kill and chop dem, bikos dem nor get who dey guide dem. My shepads nor even try to look for di sheep, instead na diasef dem kare about. So make una listin to mi. 10 Mi wey bi God wey get pawa dey sey I bi una enemy. I go take my sheep from una hand and una nor go bi dia shepad again; I nor go let una kare for unasef again. I go save my sheep from una and una nor go chop dem again.
Di Good Shepad
11 “ ‘Mi wey bi God wey get pawa dey tell unasef sey, mi mysef go look and kare for my sheep, 12 just as shepad dey kare for dia sheep wey skata kon gada dem again. For dat day wen di wahala go start, I go bring dem kom back from where dem skata go. 13 I go remove dem from strenja land; gada dem togeda kon bring dem back to dia own kountry. I go lead dem go back to di mountin and Israel river wey dey flow kon give dem betta food chop. 14 I go let dem stay for peace for di mountins, valleys and all di fine field. 15 Na mi mysef go bi dia shepad and I go give dem place to rest.
Mi, God wey get pawa, don tok.’ ”
16 “Doz wey don lost and wey waka anyhow, I go find and bring dem kom back. Doz wey get sore, I go bandage am for dem kon heal doz wey dey sick; but doz wey fat and strong, I go distroy dem, bikos I bi shepad wey dey do wetin dey rite.
17 “Naw my sheep, mi wey bi God wey get pawa dey tell una sey I go judge each of una kon separate di good ones from di bad ones; dat is, di sheep from di goat. 18 Some of una nor dey beleful; even doh una dey chop betta grass, una still dey mash wetin una chop remain! Una dey drink klean wota kon dirty di ones wey una drink remain! 19 Na my oda sheep go kom chop di grass wey una don mash and drink di wota wey una don dirty?
20 “So naw, mi God wey get pawa dey tell una sey, I go judge both di strong and di weak sheep. 21 Yes! Una push di ones wey dey sick kon drive dem komot from where di oda sheep der. 22 But I go save my sheep and I nor go let una trit dem anyhow again. I go judge my sheep dem kon separate di good ones from di bad ones.
23 “I go give dem king wey bi like my savant David, wey go bi dia shepad and e go kare for dem. 24 Mi God go bi dia God and one king like my savant David go rule dem.
Mi, wey bi God, don tok.”
25 “I go make kovenant wey go guide and protet dem. I go distroy all di wiked animals for di land, so dat my sheep go fit stay for peace as dem dey di field and forest. 26 I go bless dem kon let dem stay near my holy hill and for der, I go bless dem with betta rain anytime wey dem wont am. 27 Dia tree go bear fruits; dia fields go bear betta plant and evribody go stay for peace for en land. Wen I don break di shain wey dem take tie my pipol kon free dem from pipol wey dey trit dem like slave, den dem go know sey na mi bi God. 28 Di kountries wey hate dem nor go disturb dem again and wiked animals nor go kill or chop dem again. Dem go stay for peace and nobody go make dem fear again. 29 I go make dia groun dey bear betta plant and honga nor go dey again. Di oda kountries nor go laf dem again. 30 Evribody go know sey na mi dey protet Israel and dem bi my pipol.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
31 God wey get pawa sey, “Una bi my sheep; di animals wey I dey feed! Na una bi my pipol and na mi bi una God.”