33
Ezekiel Dey Wosh
God kon tell mi. “Man pikin, go tell yor pipol wetin go happen. Den tell dem sey: ‘If I bring war kom di land and di pipol choose one man wey go dey wosh for di gate. Wen e si dia enemies dey kom, e go ring di bell to warn evribody. If anybody hear and nor gri listin to am and di enemies kon kill-am, na-im kause en deat by ensef. En deat na-im own fault, bikos e nor gri listin to di warnin. If to sey e listin, e for run go hide. But if di wosh-man si di enemies dey kom and e nor ring di bell, di enemies go kill di pipol bikos of dia sin, but I go whole di wosh-man for dia deat bikos e nor warn dem.’
“Naw, man pikin, I dey put yu as wosh-man for Israel. Yu must go tell dem di warnin wey I dey tell yu so. If I sey wiked pesin go die and yu nor warn am to shange, so dat e go save en life, den e kon die as sina, I go whole yu for en deat. But if yu warn am and e nor gri stop to do bad tins before e die, den yor hand nor dey for en deat.”
Evribody Work
10 God kon tell mi. “Man pikin, go tell Israel pipol wetin dem dey tok: ‘Na awa sins and di wrong tins wey wi dey do, dey ponish us so. Wi don die finish so how wi won take survive naw?’ 11 Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’
12 “Naw, man pikin, go tell Israel pipol sey wen good pesin sin, di good wey e do, nor go save am. Like dis too, if wiked man stop to do bad, I nor go ponish am, but if good man start to sin, I nor go sorry for am at-all. 13 I fit promise good man good life, but if e bigin tink sey di good wey e do before go save am, den e start to sin, I nor go remember all di good wey e do. E go die, bikos of en sins. 14 Like dis too, I fit warn wiked pesin sey e go die, but if e stop di bad tins wey e dey do kon dey do wetin good and rite; 15 for ezample, if e riton di propaty wey e take from pesin, bikos e borrow am money or give pipol back wetin e tif from dem kon stop to sin, den bigin follow di law wey dey give life, e nor go die and e go get long life. 16 I go forgive en sins and e go get di life wey nor dey end, bikos e don do wetin dey rite and good.
17 “With all dis, yor pipol dey sey wetin I dey do nor dey rite. No! Na dia ways nor dey rite. 18 Wen pesin wey good for God eye stop to do good kon dey do bad tins, e go die bikos of di bad tins wey e dey do. 19 But wen wiked pesin stop to sin kon dey do wetin dey good for God eye, e don save en life bi dat. 20 But Israel pipol, una sey wetin I do, nor good. So I go judge una with wetin una dey do.”
Jerusalem Don Fall
21 Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di tent mont, one man wey eskape from Jerusalem, kom tell mi sey, “Di town don fall.” 22 But for di evening before e kom, I feel as God present strong rish. So wen di man kom di next morning, God kon give mi di pawa to tok.
Di Pipol Sin
23 God kon tell mi. 24 “Man pikin, di pipol wey dey stay di empty town for Israel dey sey: ‘Abraham na just one man and dem gi-am di whole land. So naw wey wi many well-well, na wi get di land too.’ 25 Naw, make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘Una dey chop meat with dia blood; dey woship juju and dey kill pipol. So wetin make una tink sey na una get di land? 26 Una bilive sey una get pawa; dey bihave anyhow and evribody dey sleep with who nor bi dia husband or wife. So wetin make una dey tink sey na una get di land?’
27 “Go tell dem sey mi, God dey warn dem sey, ‘As long as I bi di God wey dey alive, di pipol wey dey stay for di main field, go die. Wiked animals go chop doz wey dey stay for di kountry and na diziz go kill doz wey hide for mountin and whole. 28 I go make di kountry empty finish kon end di pawa wey make dem dey proud before. Israel mountins go empty and nobody go fit travel pass der again. 29 Wen I ponish di pipol for dia sin kon make di kountry empty, den dem go know sey na mi bi God.’ ”
Di Result
30 God sey, “Man pikin, yor pipol dey tok about yu wen ever dem meet for di town wall or for dia house door-mot. Dem dey tell each oda sey, ‘Make wi go hear wetin God tok.’ 31 So all di pipol gada kom listin to yu, but dem nor gri do wetin yu tell dem. Dem sey dem dey do di rite tin, but dem dey always dey shit and tif pipol money. 32 To dem, yu bi like pesin wey dey joke, sing love song or play harp. Dem dey listin to evry word wey yu tok, but dem nor dey obey any one. 33 But wen wetin yu tok don happen and e go happen, den dem go know sey na profet dey with dem since.”