38
God Dey Use Gog
God sey, “Man pikin tok against Gog, dat wiked prince wey dey rule Meshak and Tubal wey dey Magog land. Tell am sey mi God wey get pawa na en enemy. I go turn am round; hook en jaw kon drag en and en plenty sojas. I go drag Persia, Ethiopia and Libya sojas follow dem; plus all di swod wey dem karry.
“All di men wey sabi fight for Gomer and Togarmah land for nort and men from difren kountries, tell dem make dem dey ready with all dia many sojas and na yu go kommand dem, bikos afta sometaim, I go kommand una to attack Israel land; kountry wey bin skata bikos of war. Nobody stay di land since, but en pipol don kom back from oda kountries where dem bi prisonas before. Naw, Israel pipol dey stay for peace for dia land. Yu, yor sojas and all di many kountries wey dey with yu go attack Israel like betta strong rain and una go bi like kloud wey kover di eart.”
10 Dis na wetin God wey get pawa dey tell Gog: “Wen dat time don rish, yu go start to tink of di wiked tins wey yu go do. 11 Yu go skata Israel kountry wey nor get who dey protet dem; place where di pipol nor get pawa and dey stay for peace. 12 Doz wey dey stay dis town wey nor skata before, yu go skata and karry dia propaty go. Dis pipol na prisonas for oda kountries before, but naw, dem don get plenty animals and propaty, so dem feel sey na dem get di whole world. 13 Sheba and Dedan pipol with doz for Tarshish go kom meet yu sey dem wont make yu give dem some from di silva and gold, plus di animals and propaty wey yor sojas kollect from Israel land.”
14 So, God wey get pawa kon send mi go tell Gog wetin E tok: “Naw, as my pipol Israel dey stay for peace, yu go 15 from yor land go take many sojas from difren kountries too, both from nort and all of dem go karry shariot. 16 Yu and yor pipol go attack my pipol like strong kloud wey dey pass di land. Wen di time don rish, I go send yu go skata my land, so dat dem go know who I bi and dem go si as I holy rish, bikos of di tins wey I go do thru yu.
17 “Na yu I dey tok about before wen I tell my savant wey bi Israel profet sey, ‘For dat day, I go ask somebody make e attack Israel.
God wey get pawa don tok.’ ”
God Ponish Gog
18 God wey get pawa sey, “Wen Gog go attack Israel, I go vex well-well. 19 I go vex kon sey, ‘For dat day, many eartkweke go happen for Israel. 20 All di fish, bird, animal; weda dem big or small and evry human being wey dey stay dis eart, go fear mi well-well. Mountins go fall; high hill go skata and evry wall go fall skata too. 21 I go make Gog fear mi kon ponish am with diziz.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.’ ”
“Gog men go fight and kill each oda. 22 I go ponish am with diziz and en pipol go dey kill each oda anyhow. Heavy rain, big-big stones, fire and sulfur go fall on-top en and en sojas; plus all di oda kountries wey dey en side. 23 Na like dis I go take show all di kountries as I dey great and holy rish. Den, dem go know sey na mi bi God.”