39
Dem Win Gog Pipol
God wey get pawa sey, “Man pikin, go tok against Gog wey dey rule Meshak and Tubal sey, ‘I bi en enemy. I go take am go anoda place for nort until e rish Israel mountin. Den I go nak en bow komot from en left hand and di arrow wey dey en rite hand. Gog, en sojas and all di pipol wey dey stay with am go die finish for Israel mountin and I go let bird and wiked animals chop dia body. Dem go die for war.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.’
“I go set fire put for Magog land and land near di river where pipol dey stay for peace. Den evribody go know sey na mi bi God. I go make sure sey Israel, my pipol know my holy name and I nor go let dem disgrace my name again. Den di pipol go know sey na mi bi di God wey dey holy.”
God wey get pawa sey, “Wetin I dey tok about, go must kom. Di pipol wey dey stay Israel town go-go kollect doz tins wey dem take dey kill pipol kon use am do firewood and dem bi: di swod, di shield, di bow, di arrow, di spear and dem go use dem as firewood for seven years. 10 Dem nor nid to go gada wood for di field or go kut tree for forest, bikos di swods go rish dem take make fire. Doz wey tif and karry my pipol propaty before, my pipol go kollect di load back from dia hand.”
God wey get pawa don tok.
Dem Beri Gog
11 God sey, “Wen all dis tins dey happen, I go give Gog one grave for Travelas Valley wey dey di Dead Sea for Israel east. Dem go beri Gog and all en sojas for der and dem go koll am ‘Hamon-Gog Valley.’ 12 Na seven mont e go take Israel pipol to beri all di dead body kon make di land klean again. 13 Evribody for di land go join beri dem, den pipol go respet dem afta dem don win di fight.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
14 “Afta di sevent monts, dem go choose men wey go travel round di land, so dat dem go fine and beri di dead body wey remain, so dat di land go dey klean. 15 As dem dey travel round di kountry, wons dem si human being bone, dem go mark dat place, so dat doz wey dey beri go si di bones kon beri dem for Hamon-Gog Valley. 16 (E get one town for der and dem go gi-am Gog sojas name wey bi Hamonah.) So di land go dey klean again.”
17 God wey get pawa kon tell mi, “Man pikin, go koll all di birds and animals make dem kom from evriwhere kon chop di sakrifice food wey I dey make for dem. Na party dem won do on-top Israel mountin so and dem go chop and drink blood. 18 Dem go chop sojas body kon drink ruler and leaders blood; all dis pipol go die like ram, sheep, goat or like big melu. 19 Wen I kill dis pipol as sakrifice, di birds and animals go chop evry part wey dem fit chop kon drink blood until dem nor fit drink again. 20 For my tabol, dem go chop all wetin dem fit chop from shariot and from all di sojas body.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
Israel New Life
21 God sey, “I go let di kountry si my glory and I go show dem how I dey judge well with my pawa. 22 Den from dat day go, Israel pipol go know sey na mi bi di Oga wey bi dia God. 23 All di kountries go know sey Israel go Babilon as slave, bikos of sin and I turn leave dem kon let dia enemies beat and kill dem for war. 24 I give dem wetin dem ask for and bikos of dia sin and wikedness, I waka leave dem.”
25 God wey get pawa sey, “But naw, I go sorry for Jakob shidren wey bi Israel pipol kon make dem prosper again. Yes! I go guide my holy name. 26 Wen dem don dey stay dia on land with peace and nobody dey treaten dem again, den dem go forget how dem sofa before wen dem dey sin against mi. 27 For all di enemies land where my pipol dey stay, I go bring dem kom back to dia own land, den evribody go know sey I dey holy. 28 Den my pipol go know sey na mi bi di Oga wey bi dia God. Dem go know, bikos I send dem go anoda land prisonas before, but naw, I don gada dem from all di kountries where I skata dem go before kon bring dem back to dia land and I nor forget or leave anybody for der. 29 I go pour my Spirit put for Israel pipol body and I nor go leave dem again.
Mi, God wey get pawa, don tok.”