47
Di Temple River
Den di man bring mi kom di temple front and I si wota dey kom out from under di gate dey rush go east; di place wey di temple face. E dey flow well for di sout-side for di temple near di altar. Di man take mi pass di nort gate and wi kom out from di temple gate wey face east. And wota dey flow kom out from di sout-side for di gate. As di man waka go di east side with en tape, e measure 1,000 and seven hundred and fifty fit, and e sey make I waka pass am. Di wota rish mi for my leg. Den e measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit kon sey make I enter and di wota kon rish mi for my knee. E measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit and dis time di wota kon rish my waist. E still measure anoda 1,000 and seven hundred and fifty fit, den di wota kon turn river and I nor fit cross am. E too deep to cross escept yu sabi swim. E kon tell mi, “Man pikin, yu don si dis tin before?”
Den di man take mi go back to di wotaside and wen I rish der, I si sey many trees dey di wotaside. E tell mi, “Dis wota dey flow go di east, den from der go Jordan River Valley kon enter di Dead Sea. Afta di wota don flow go di Dead Sea wey get salt taste, di sea go kon turn to fresh wota. Anywhere di wota flow go, animals and fish wey dey dat place, go still dey alive. Di wota go make di Dead Sea wota fresh and anywhere dis wota flow go, evritin for der, go get life. 10 For En-Gedi go rish En-Eglaim wota, pipol dey go der go katch fish. Dem dey katch difren fish for der just as dem dey katch for Mediterranean Sea. 11 But di wota wey dey flow pass and di ones wey dey di bush side, nor fresh at-all, bikos e dey taste like salt. 12 For each side for di river, difren trees dey grow for der. Dia leaf nor go dry and dia fruit nor go fall, but dem go dey produce good food evry mont and dia leaf go dey cure doz wey dey sick, bikos di wota wey dey survive dem dey flow kom from di temple.”
Di Land Boundary
13 God wey get pawa sey, “Dis na di land wey yu go divide among di twelf tribes for Israel. But Josef tribe go get two. 14 Yu must divide am ekwol, bikos I promise una grand-grand papa sey di land go bi dia own.
15 “Dis go bi di land boundary and e go bi from di nort side go di Mediterranean Sea kon rish Hetlon town and from Hamat Pass go Zedad town; 16 from Berotah and Sibraim (wey dey between Damaskus and Hamat kingdom) go rish Tikon town (wey dey di boundary for Hauran kingdom). 17 Di boundary go start from di Mediterranean sea go rish Hazar Enon town with Damaskus and Hamat boundary for nort. 18 Di boundary for east na from sout between Damaskus and Hauran with Jordan River wey bi boundary between Israel land for west and Gilead for east go rish Tamar for di Dead Sea. 19 Di boundary for sout na from sout-west for Tamar go rish Kadesh Meribah; den go rish nort-west along Egypt boundary for Mediterranean Sea. 20 Di west boundary na from Mediterranean Sea go rish di nort side for west wey bi Hamat Pass.
21 “So, make yu divide dis land among di tribes for Israel. 22 Di strenjas wey dey among una and di ones wey born dia shidren for here, go still kollect dia own share wen una dey divide di land. Una go trit dem as una dey trit Israel pipol and dem go trow dice for each land wey go bi any tribe for Israel own. 23 Each strenja for di land go kollect dia share with di tribe wey dem dey stay with.
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”