46
Di Prince And Di Festival
God wey get pawa sey, “For di six days for di week wen una take dey work, make dem dey always klose di east gate wey dem dey pass enter di kourtyard, but make dem open am for Sabat Day and for di New Moon Festival. Di prince wey dey rule go pass outside di kourt enter di big room kon stand near di door-mot wen e won burn di sakrifice and offa di fellowship ofrin. For di gate der, e go woship God kon go out back. Dem must nor lock di gate till evening. For evry Sabat Day and New Moon Festival, all di pipol must bow woship God for di gate for front. For Sabat Day, di prince go offa six sheep and one ram as sakrifice give God and all di animals must dey okay. For one ram, e go karry half bag of korn follow am as ofrin and for one sheep, e go take anytin wey e fit take go as ofrin. For evry half bag of korn ofrin, e go karry three kwota of olive oil follow body. For di New Moon Festival, e go take one yong melu, six sheep and one ram and all of dem must dey okay. For one melu and ram, e go take half-half bag of korn follow body as ofrin and for di sheep, di ofrin go bi anytin wey e like to offa. For evry half bag of korn ofrin, e go karry three kwota of olive oil follow body. Di prince must komot from di big room for di gate kon go back just as e take kom.
“Wen dem dey do festival and di pipol kom woship God, anybody wey pass di nort gate enter go use di sout gate go out afta dem don woship finish and doz wey enter thru di sout gate go pass di nort gate komot. Make nobody go out thru di gate wey e take enter, but make e pass di opposite gate kom out. 10 Di prince go kom inside wen di pipol don kom and e go komot wen di pipol don go.
11 “For di festival, di korn wey dem go offa go bi half bag with one melu and ram and anytin wey di pipol won give with dia ram. For evry half bag for di korn ofrin, dem go karry three kwota of olive oil follow body. 12 Wen di prince won kom just give God ofrin from en mind, weda na burnt or fellowship ofrin, dem go open di east gate where dem dey pass enter di kourtyard, for am. E go give di ofrin just as e dey offa am for Sabat Day and wen e don go out, dem go must klose di gate.”
Evriday Ofrin
13 God sey, “For evry morning, una go burn one sheep pikin wey bi one year as ofrin give mi and e go dey okay. Na evriday una go dey do dis ofrin. 14 Una go still dey give mi five pound of flower evry morning with one kwota of olive oil wey dem mix with flower. Una must kontinue to give dis ofrin forever. 15 Evry morning, una go offa di sheep pikin, di flower and di olive oil give God as ofrin forever.”
Di Prince And Di Land
16 God wey get pawa sey, “If di prince wey dey rule give any of en land to en son as gift, dat land go bi di pikin own forever. 17 But if di prince wey dey rule give any of en land to en savants, e go bi di savant propaty until wen Freedom Year go rish, before e go bi di prince own again. Na-im and en son get en propaty dem forever. 18 Di prince wey dey rule nor go take any propaty wey nor bi en own. Any land wey e give en son must bi from di land wey bi en own, so dat e nor go opress any of my pipol or take dia land.”
Di Temple Kishen
19 Den di man take mi go front of di room wey face di nort, near di gate for di sout-side for di inna kourt. Dis na di holy room for di priests. E show mi one place for di west side for di room 20 kon sey, “Dis na di place where di priest go boil di meat, wey dem go offa as sakrifice for sin ofrin and na der dem go for bake di bread too, so dat dem nor go karry anytin wey dey holy go outside di kourt kon kause trobol for di pipol by mistake.”
21 Den e karry mi go outside for di kourt kon take mi pass di four korna for di kourt and each side for di four korna get kourt 22 wey long rish seventy fit and wide rish fifty-two and half fit. 23 Each of dem get stone round am and dem still get where dem for dey boil di ofrins under am. 24 Den di man kon tell mi, “Na dis bi di kishin where di temple savant go for boil di sakrifice meat wey di pipol offa.”