5
Ezekiel Kut En Hair
God sey, “Man pikin, use sharp knife take kut yor hair and bear-bear. Put di hair for skale kon divide am into three part. Burn di third part for fire afta yor work don finish. Take anoda part kon kut am anyhow for outside di town. Den make yu skata di remainin part for air and I go use my swod take distroy dem. Make yu keep and tie some of di hair for yor klot. Yu go still take some kon trow dem for fire make dem burn. From der, one fire go spread go all Israel family.
“Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Na Jerusalem bi dis; I put am for difren nashon centre and difren kountries dey round am. But Jerusalem nor do wetin I kommand and e show sey e wiked pass di oda nashons. E disobey mi pass all di kountries wey dey round am. Jerusalem rijet my kommand and e nor gri receive my laws.
“So Jerusalem pipol make una listin: Na mi bi Oga God! Una nor gri obey my laws or tishings, instead una dey do wetin di oda nashons dey do. Una even sturbon pass di tribes wey dey near una.
“So mi God dey tell una sey I dey against una. Naw, all doz nashons go dey look as I dey ponish una, bikos una don bi my enemy. Bikos of all di tins wey una do; tins wey I hate well-well. So I go ponish Jerusalem as I neva do before, but I nor go ponish dem like dat again. 10 Bikos of dis, for Jerusalem, papa and mama go chop dia pikin and shidren go chop dia papa and mama. I go ponish una and doz wey go remain wey nor die, I go skata dem for evriwhere for dis world.
11 “So as long as mi God dey alive and as una don spoil my temple with una juju and all di bad tins wey una dey do, I nor go sorry for una wen I dey distroy una. 12 Some of una go die bikos of honga; sickness go kill some; swod go kill anoda set for outside di town and di remain wons, I go skata dem for air kon porshu dem with my swod. 13 So my vexnashon go end and my ponishment go rest for dia head, den I go dey okay. Wen all dis tins don happen, una go si, undastand and know sey na mi God, tok to una.
14 “All di pipol wey dey di oda nashons near una, wen dem waka pass, dem go dey laf and fool una, bikos of how God take distroy una land. 15 Wen I vex kom ponish una, all di nashons near una, go fear. Dem go shake dia head and laf as dem dey look una. 16 I go let honga kill una and una nor go si food chop. Una go feel my vexnashon like arrow wey dem take shot pesin. 17 So, I go send honga and wiked animals kom meet una and dem go kill una shidren. Na trobol and deat go dey una land and I go raiz my swod against una.
Mi, wey bi God, don tok.”