6
God Nor Like Juju
God tell mi sey, “Man pikin, look where Israel mountin dey, make yu tok against dem. Tell di mountin for Israel sey make e hear wetin God dey tok; make e hear wetin mi di God wey get pawa dey tok. I dey tell di mountin, hills, river and di valley sey: I go send swod go distroy di place where pipol for dey woship juju. I go skata di juju kon broke dia incense altar. I go kill all di pipol for dia juju front. I go skata Israel pipol dead body for evriwhere; I go skata dia bones round di altar. I go distroy all di towns for Israel kon skata dia juju and en altars, den evritin wey dem make, go disappear. I go kill pipol for evriwhere and doz wey go remain, go know sey, na mi bi God.
“I go let some of dem eskape di kilin, but I go skata dem go difren kountries where dem go for bi strenja. Dat time, dem go remember kon know sey I don ponish and disgrace dem, bikos dia heart rijet mi and dem kon decide to serve juju. Dem go hate demsef, bikos of di bad and wiked tins wey dem don do. 10 Dem go know sey na mi bi God and I mean am wen I sey I go distroy dem.”
11 God still sey, “Make yu klap yor hand! Mash di groun well-well! Cry with pain kon sey, ‘Bikos of all di wiked and bad tins wey Israel pipol don do, dem go die for war or honga and diziz go kill dem trowey. 12 Doz wey dey stay far, na sickness go kill dem; doz wey dey here go die for war; doz wey survive, na honga go kill dem. Dem go feel how my vexnashon strong rish. 13 Dead body go skata round dia juju and en altars; both for dia hill and on-top evry mountin, under evry green tree and evry oak tree and for evriwhere wey dem for dey burnt sakrifice give dia juju. Dat time, evribody go know sey na mi bi God. 14 Yes, I go vex distroy dia land. I go make dia land empty and from sout, e go bi like desert go rish Diblah town for nort. Yes! E go bi like dat for evriwhere wey dem dey stay. Dat time, dem go know sey na mi bi God.’ ”