3
Haman Plan To Kill Jew Pipol
Afta, King Zazes kon promote Haman wey bi Hammedata pikin from Agag town. E make en pozishon high pass evry oda pozishon for di kingdom. Bikos of dis, all di king savants wey dey for di king gate kon dey bow and respet Haman, bikos di king don kommand sey make e bi like dat. But, Mordekai nor gri bow or gi-am respet.
So di king savants wey dey di palis gate kon ask Mordekai, “Wetin make yu dey go against di king kommand?” And wen dem tok to Mordekai well-well and e nor ansa dem, dem kon tell Haman wetin Mordekai dey do, so dat dem go hear wetin Heman go tok, bikos Mordekai don tell dem sey en na Jew.
Wen Haman si sey Mordekai nor gri bow or gi-am respet, e vex well-well and since e don know naw sey Mordekai na Jew, e kon sey e go ponish am well-well. E kon dey plan to kill all di Jew wey dey di kingdom.
For di twelft year wen King Zazes dey rule, for di first mont wey bi Nisan, Haman kon sey make dem trow dice (na Purim dem dey koll am), so dat e go know di rite day and mont to do wetin e plan. E kon agri to do en plan for di thirtint day for di twelft mont, wey bi Adar.
So Haman tell di king, “E get one tribe wey dem full evriwhere for dis yor kingdom wey get difren law. Dem nor dey follow di king law. So e nor dey good for di king to allow dem live. So my oga, if yu wont, make yu kommand make dem kill all dis pipol. If yu do like dat, den I go get like 10,000 big sak for silva for di royal pus for di kingdom.”
10 Di king kon remove en ring wey dem take dey stamp law, so dat e go get pawa kon gi-am to Haman wey bi Hammedata pikin from Agag and dis Haman na Jew enemy. 11 Di king tell am, “Make yu nor worry about di money, just go do wetin yu like with di pipol.”
12 So for di thirtint day for di first mont, Haman koll di king seketry kon sey make e rite dis kommand for all di language for di kingdom kon send am go meet all di rulers, govnors and ofisas for di kingdom. Dem rite am with King Zazes name kon stamp am with en ring. 13 Di messenjas take di kommand go all di aria for di kingdom. And di law wey dey inside sey for di thirtint day for Adar mont, dem must kill all Jew pipol; weda dem yong or old, both wimen and shidren kon take all dia propaty. 14 Dem must read dis kommand to evribody for di kingdom, so dat dem go dey ready wen dat day go rish.
15 Just as di king kommand, dem kon tok evritin for di main town for Shushan and di messenjas karry am go evriwhere for di kingdom. Di king and Haman dey drink and enjoy diasef, while evribody for Shushan town, dey run up-and-down.