4
Estha Help En Pipol
Wen Mordekai hear evritin wey dey happen, e tear en klot kon wear sak, pak ashes for en head; den e go di town centre kon dey kry. But e nor waka pass di king gate: bikos nobody wey wear sak klot go fit pass der. And for evry aria where dem for read dis law, Jew pipol wey dey der, dey kry, fast, wear sak klot kon pak ashes for dia head.
Wen Estha savants tell am wetin dey happen, e vex well-well kon sey make dem go remove Mordekai sak klot kon wear am betta klot, but Mordekai nor gri. Den Estha koll Hatak, one offisa for di palis wey di king sey make e dey serve am kon send am go ask Mordekai, make e tell am wetin dey happen.
Hatak go meet Mordekai for di town centre for di palis gate. Mordekai tell am evritin wey dey happen and all di money wey Haman sey di kingdom go get, wen dem don kill all Jew pipol. E give Hatak one kopy for di kommand wey dem read for Shushan, sey make dem kill all Jew pipol. Mordekai sey make e go give and tell Estha evritin, so dat e go beg di king make e sorry for en pipol.
Hatak do as Mordekai tell am, 10 den Estha sey make e go give Mordekai dis message: 11 “If anybody, weda na man or woman enter di inna kourtyard go si di king without sey e koll am, dat pesin must die. Dat na di law; evribody from doz wey dey advise di king go rish evriwhere for di kingdom, know sey na so e bi. But na only one way wi fit take break dis law: if di king show pesin en gold rod, den dem nor go kill dat pesin. But e don rish one mont since di king sey make dem koll mi kom.”
12 Wen Mordekai hear Estha message, 13 e kon sey make dem go warn am, “Make yu nor feel sey yu dey save pass any oda Jew pesin, bikos yu dey stay for palis. 14 If yu keep kwayet for dis time, God go send help kon from heaven and wi go dey save, but yu go die and yor papa family go end. Yu know weda na bikos of dis tin, na-im make yu bi kween!”
15 So Estha ansa Mordekai: 16 “Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”
17 So Mordekai kon go do evritin wey Estha tell am.