6
Di King Honor Mordekai
Thru-out dat nite, di king know fit sleep, so e sey make dem bring di ofisas rekord book for di kingdom kom, den dem kon bring and read am for am. Di part wey dem read, na about how Mordekai take tok about Bigtan and Teres (di king ofisas before) wey bin dey plan to kill King Zazes.
Di king kon ask, “Wi don honor and reward Mordekai for dis tin wey e do?”
Di king savant ansa, “No! Wi neva do anytin for am.”
Den di king ask, “Any of my ofisas dey di palis?” Naw, Haman just dey enter di palis make e kom tell di king, sey make dem hang Mordekai.
Di king savants tell di king, “Haman just dey enter.”
So di king sey, “Make una koll am kom.”
So Haman enter inside and di king kon tell am, “Wetin wi fit do for di man wey di king like to honor?”
Haman kon tink for en mind sey, “Wish pesin di king go wont honor, escept mi?” So Haman tell di king, “Make yu tell di savant make dem bring di king royal garment and di royal horse wey di king don ride before, kom. Den make one of di king men dress di pesin kon dey lead am thru di town as e dey on-top di horse. Make di king offisa dey shaut as dem dey go sey: ‘Make una si how di king dey reward di pesin wey e choose to honor!’ ”
10 Den di king tell Haman, “Make yu go kwik-kwik! Kollect di garment and horse, den do all dis tins wey yu tok for Mordekai, di Jew wey dey di palis gate.”
11 So Haman take di klot and di horse kon wear dem for Mordekai. Den e kon lead am thru di town dey shaut, “Make una si how di king dey reward di man wey e choose to honor.”
12 Den Mordekai go back to di palis gate, while Haman kover en face with shame kon run go house. 13 Haman kon tell en wife Zeresh and all en friends evritin wey happen to am.
En friends with en wife Zeresh kon tell am, “Yu don dey luz pawa to dis Mordekai. E bi Jew pesin and yu nor go fit win am. True-true e go win yu.” 14 As dem still dey tok, di palis offisa kon hurry kom, so dat e go karry Haman go Estha party.