5
Estha Beg Di King
For di third day, Estha wear en royal dress kon go stand for di inna kourtyard gate for di palis wey face di throne room and di king sidan for di throne. Wen di king si Estha for di gate, belle sweet am, den e stresh en gold rod and Estha kon go tosh di rod.
Di king ask am, “My kween, wetin dey happen? Make yu tell mi anytin wey yu wont (even if na half of my kingdom), I go gi-am to yu.”
Estha ansa, “Abeg my king, I go like make yu and Haman kom di party wey I dey organize for yu.”
So di king sey make dem koll Haman kom kwik-kwik, so dat dem go-go Estha party.
Leta dat day, dem kon go di party. As dem dey drink, di king kon ask Estha, “Make yu tell mi wetin yu wont and I go do am for yu; even if na half of my kingdom yu ask for.”
Estha ansa, “Dis na wetin I dey ask and pray for: If my oga really wont do wetin I go ask for, I go wont make yu and Haman kom di party wey I go do for una tumoro, den I go tell yu wetin I wont.”
Haman Plan To Kill Mordekai
Wen Haman dey go en house afta di party, e kon dey happy and belle sweet am. But e kon si Mordekai for di palis gate and wen Mordekai nor greet am as e dey pass, Haman kon dey vex well-well. 10 But e kontrol ensef kon go house.
Den e invite en friends kom en house kon sey make en wife, Zeresh join dem. 11 E kon dey boast give dem sey e get money well-well; many sons; how di king don promote am and how e dey important to di king pass any oda offisa. 12 Haman still sey, “Na wetin remain? Even di kween do party for di king and na only mi e invite to follow am and e still sey make wi kom back tumoro. 13 But all dis tin nor mean anytin as long as I dey si dat Jew wey koll ensef Mordekai for di palis gate.”
14 So Zeresh en wife and en friends kon sey, “Go make one pole where dem dey hang pesin put and make e high rish seventy-five fit. Tumoro morning, make yu tell di king sey make dem hang Mordekai for der, den belle go sweet yu go di party.” Haman like wetin dem tok, so e kon make di pole.