14
Israel Pipol Cross Di Red Sea
Den God tell Moses, “Make yu tell Israel pipol sey make dem go stay for Pi Hahirot wey dey between Migdol and di Red Sea opposite Baal Baal-Zefon. Fero go tink sey Israel pipol konfuse kon dey waka up-and-down for di wildaness. I go make Fero heart strong again and e go porshu una and una go honor mi, bikos of wetin I go do Fero and en sojas, den Egypt pipol go know sey na mi bi Oga God.” So Israel pipol do as Moses tell dem.
Wen dem tell Fero sey Israel pipol don go, en heart and en savants heart kon turn against Israel pipol. So dem sey, “Wetin even make us do dis tin? Naw wey wi don free Israel pipol, na who go kon dey serve us?” Di king kon ready en and en sojas shariot. Den e take six hundred of en best shariot and all di horse for Egypt and di sojas wey go ride dem. God make Fero heart strong well-well, so e kon porshu Israel pipol. Naw Israel pipol just komot Egypt with betta mind. Egypt sojas porshu dem with all dia shariot and Fero shariot and dem katch Israel pipol for dia kamp for Pi Hahirot and Baal Baal-Zefon wey dey near di Red Sea near.
10 Israel pipol look up kon si Fero and Egypt sojas dey mash kom meet dem. Fear katch dem, so dem shaut kon kry to God.
11 Den di pipol tell Moses, “Na bikos grave nor dey Egypt, naim make yu bring us kom inside dis wildaness, so dat wi go die for here? Na wetin make yu karry us komot from Egypt? 12 Wi tell yu for Egypt sey, ‘Make yu leave us as wi dey serve Egypt pipol! E for betta sey wi dey serve Egypt pipol, dan to kom die inside dis wildaness o-o!’ ”
13 Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again. 14 God go fight for una, so make una nor worry.”
15 Den Oga God tell Moses, “Wetin make yu dey kry to mi? Tell di pipol make dem move go front. 16 But make yu yorsef raiz yor stik kon take am divide di Red Sea, so dat Israel pipol go waka pass for dry groun. 17 But I go make Egypt sojas heart strong, so dat dem go porshu una and pipol go honor mi, bikos of wetin I go do to Fero, en shariot and doz wey dey ride dem. 18 Den Egypt pipol go know sey na mi bi God wen I don kollect my glory for wetin I go do Fero, en shariot and doz wey dey ride dem.”
19 God angel wey dey lead Israel pipol kon go dia back and di kloud move komot from dia front go dia back. 20 Di kloud dey between Egypt pipol kamp and Israel pipol own. Di kloud make evriwhere dark for Egypt pipol, but give lite to Israel pipol, so dem nor fit near each oda till day break.
21 So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land. 22 So Israel pipol waka pass di sea for dry groun; di wota kon form wall for dia rite and left side. 23 All Fero shariot and doz wey dey ride dem kon porshu Israel pipol enter di Red Sea for dry land. 24 As day won break, God look Egypt sojas thru di fire and di kloud kon make dem konfuse. 25 E make dia shariot taya sink and dem nor fit ride fast, den Egypt sojas kon sey, “Make wi run go back from dis pipol, na God dey fight us bikos of dem.”
26 God kon tell Moses, “Make yu stresh yor hand face di sea, so dat di wota go fall kon kover all Egypt sojas, dia shariot and doz wey dey ride dem.” 27 So Moses stresh en hand face di sea and wen morning rish, di sea don go back to di way e bi before. For dis time, Egypt sojas try to run from di wota, but God kill all of dem inside di sea. 28 Di wota fall kover di shariot with doz wey dey ride dem and all Fero sojas wey porshu Israel pipol enter di sea, kon die.
29 But Israel pipol waka pass di sea for dry groun and di wota form wall for dem, both for dia rite and left side. 30 So for dat day, Oga God save Israel pipol from Egypt pipol hand. Leta, Israel pipol kon si Egypt pipol dead body for di wotaside. 31 Wen Israel pipol si how di Oga dia God take fight Egypt pipol with en mighty pawa, dem kon dey fear am. So, dem kon bilive God and en savant, Moses.