15
Moses Song
Den Moses and Israel pipol bigin sing dey praiz God sey,
“Wi go sing to God,
bikos E don give us viktory.
E trow di shariot and doz wey dey ride dem
inside di sea.
Na God bi my pawa and Savior.
Dis na my God and I go praiz am.
My grand-grand papa dem God and
I go sing about how E great rish.
Awa Oga sabi fight war,
na God bi en name.
E trow Fero shariot,
all en sojas and strong ofisas
inside di Red Sea kon kill dem.
Di deep sea kover dem;
dem sink go bottom like stone.
 
My Oga God, yor rite hand
get betta pawa
and e skata di enemies to pieces.
With yor pawa as King,
Yu don fall doz wey stand to fight Yu.
Yu burn dem like dirty,
bikos Yu dey vex.
Yu breath from yor nose
and di wota kon full.
Di river wey dey flow
kon stand like wall
and di part wey deep pass for di sea,
kon strong.
 
Di enemies sey, ‘I go porshu,
katch, divide dia propaty
kon take evritin wey I wont.
I go distroy dem with my swod.’
10 But Yu breath from yor nose
and di sea swallow dem.
Dem sink like stone
inside di big sea.
 
11 My Oga God!
Who bi like Yu among oda gods?
Who bi like Yu?
Di One wey dey holy,
wey dey do mirakles and great tins?
12 Yu stresh yor rite hand
and di groun swallow dem.
 
13 With yor true love, Yu go lead di pipol
wey Yu save
and with yor pawa,
Yu go show dem di way
to yor holy land.
14 Oda kountries go hear wetin happen
kon fear Yu;
betta fear go hold Filistia pipol.
15 Den Edom leaders go fear well-well;
di strong men for Moab
go dey shake
and di pawa wey Kanaan pipol get,
go vanish.
16 Betta fear go katch dem
and with yor great pawa,
dem go bi like stone
kon dey fear
until di pipol wey Yu save,
go waka pass.
17 Yu go take dem enter inside di land
kon plant dem for yor mountin;
di place where Yu choose as yor house,
bikos na Yu wey bi my Oga God,
build am as yor own Temple.
18 God go reign forever and ever!
Miriam Song
19 “Wen Fero men with dia shariot enter di sea, Oga God kon make wota swallow dem, but Israel pipol waka pass for dry groun.”
20 Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance. 21 Miriam sey,
“Make wi sing to di Oga awa God,
bikos E don win big war;
E trow di horse and doz wey dey ride
am inside di sea.”
Di Bitter Wota
22 Den Moses lead Israel pipol from di Red Sea enter Shur wildaness. Dem travel inside di wildaness for three days and dem nor si wota drink. 23 Den dem rish Marah, but dem nor fit drink di wota wey dey dat place, bikos e bitter (na dis make dem dey koll am, Marah.)
24 So di pipol bigin komplain give Moses sey, “Wetin wi go drink?”
25 Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink.
So for der, God give dem laws kon try dia faith. 26 God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.”
27 Den dem go Elim where dem si twelf well and seventy palm tree. So dem kon stay near di wota.