2
Dem Born Moses
For dis time, one man from Levi tribe marry one woman wey kom from di same tribe. Di woman get belle kon born boy. Wen e si sey di pikin fine well-well, e kon hide am for three mont, but as e nor fit hide am again, e take basket wey dem make with soft wood kon wrap am, so dat wota nor go enter inside. E put di pikin inside kon put am near di grass dem wey dey River Nile korna. Di boy sista stand for far dey look, so dat e go si wetin go happen to am.
Den Fero dota kom di river kon baf and as en savants dey waka for di river korna, at wons di king dota kon si di basket for where di grass dem dey. So e send one among en savants go bring am kom. Wen e open di basket, e kon si di boy inside dey kry. Fero dota sorry for di pikin kon sey, “Dis go bi one Hibru woman pikin.”
Den di pikin sista kon ask Fero dota, “Yu wont make I go find one woman among di Hibru wimen wey go fit kare for dis pikin for yu?”
Fero dota ansa, “Make yu go.” So di yong girl kon go bring di pikin mama kom.
Fero dota tell di woman, “Go take kare of dis pikin for mi and I go pay yu for di work.” So di pikin mama karry am kon go kare for am.
10 Wen di pikin don big rish, di woman kon karry am go give di king dota as en pikin and e name am, “Moses” bikos e sey, “Na wota I for si am.”
Moses Run Go Midian
11 Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin. 12 As Moses si sey nobody dey look dem, e attack, kill and beri di Egypt man.
13 Wen e kom outside di next day, e si two Hibru men dey fight. So e kon tell di one wey do bad sey, “Wetin make yu dey beat yor broda like dat.”
14 Di man ansa, “Who sey make yu kom judge us? Yu dey plan to kill mi as yu take kill dat Egypt man?”
Den Moses kon dey fear, so e tink kon sey, “True-true, pipol don know wetin I do.” 15 Wen Fero hear about di matter, e kon dey fine Moses make e kill-am.
So Moses run from Fero go Midian land kon go stay near one well. 16 Naw, Midian priest get seven girls wey dey kom draw wota from di well to take feed dia papa animals. 17 So some shepad kom drive di girls komot from di well, but Moses fight for dem kon give dia animals wota.
18 Wen di girls rish house, Jetro, dia papa kon ask, “Wetin make una kwik kom house today?”
19 Dem ansa, “Na one Egypt man save us from doz shepad, den e draw wota for us kon still give di animals drink.”
20 Di man ask en dotas, “Na where dis man dey and wetin make una leave am for der? Make una go koll am kom, so dat e go follow us chop today.”
21 Moses agri to stay with dem and di man kon give en dota, Zipporah to Moses as en wife. 22 Moses wife born boy and Moses koll am, “Gershom” bikos e sey, “Na strenja I bi for dis land.”
God Koll Moses
23 Afta sometaim, Egypt king kon die, but Israel pipol still dey kry, bikos dem dey sofa well-well. So dem kry well-well to God for heaven. 24 God hear dia kry and E remember en kovenant wey E make with Abraham, Isaak and Jakob. 25 God si as dem dey sofa, so E kon dey sorry for dem.