3
God And Moses
One day wen Moses dey kare for di sheep and goat wey bi en wife papa, Jetro wey bi priest for Midian own, e kon karry di animals go far for anoda side for di wildaness till e rish di holy mountin for Horeb. Den God angel appear to am like fire for inside di bush. Wen Moses look, e si sey di fire dey katch, but di bush nor dey burn! So Moses tok for en mind sey, “I neva si dis kind tin before. I go waka near kon si why di bush nor dey burn?”
Wen God si sey Moses don near di bush, E kon koll am, “Moses, Moses!”
Den Moses ansa, “I dey here.”
God tell am, “Make yu nor waka near dis place. Remove di shoe wey dey yor leg, bikos di groun wey yu stand put so, dey holy.” E still tell am, “Na mi bi yor papa Abraham, Isaak and Jakob God.” Den Moses hide, bikos e dey fear to look God face.
God kon tell am, “True-true, I don si how my pipol dey sofa for Egypt. I don hear dia kry for help and I know how dia sofa big rish. I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay. True-true, Israel pipol kry don rish my ear and I don si how Egypt pipol dey sofa and opress dem. 10 So naw, make yu go, bikos na mi dey send yu go meet Fero and make yu take my pipol Israel, komot from Egypt.”
11 But Moses tell God, “Na who I bi to go meet Fero or to karry Israel pipol komot from Egypt?”
12 God ansa am, “True-true, I go dey with yu and dis go bi di sign to show sey na mi send yu: wen yu take di pipol komot from Egypt, yu and dem go kom serve mi for dis mountin.”
13 But Moses ansa God, “If I go meet Israel pipol kon tell dem, ‘Na una grand-grand papa God send mi kom meet una.’ Den dem ask mi, ‘Wetin bi en name?’ Na wetin I go ansa dem?”
14 God ansa, “I bi Who I bi. Dis na wetin yu go tell dem, ‘Na di God wey bi who E bi send mi kom meet una.’ ” 15 God still tell Moses, “Yu must tell Israel pipol sey, ‘God wey bi una grand-grand papa God; di Pesin wey bi Abraham, Isaak and Jakob God, na-im send mi kom meet una.’ Dis na my name forever and dis na wetin pipol go take remember mi from one generashon go rish anoda.
16 “So make yu go gada di eldas for Israel kon tell dem sey, ‘God wey bi una grand-grand papa dem, Abraham, Isaak and Jakob God appear to mi kon sey, “I don kom meet una and I si as una dey sofa. 17 I don promise sey na from Egypt where una dey sofa naw, I go for take karry una go take-ova Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol land, di place where milk and honey full.” ’
18 “Di eldas go agri with yu, so yu and di eldas for Israel must go si Egypt king kon tell am, ‘God, wey bi Hibru pipol God don kom meet us. Naw, make yu allow us travel for three days go inside di wildaness, so dat wi go fit go offa sakrifice give di Oga awa God.’
19 “But I know sey Egypt king nor go let una go, unless I force am. 20 So I go use my hand skata Egypt with all di wonders wey I go do among dem and afta all doz tins, e go let una go. 21 I go make Egypt pipol favor una, so dat una go karry tins follow body wen una dey komot from di land. 22 All di wimen for Israel go ask dia neighbour and Egypt neighbour for gold, silva and fine-fine klot. Una and una shidren go wear dem and like dis, una go finish all di tins wey Egypt pipol get!”