24
Di Kovenant
Den God tell Moses, “Make yu klimb kom meet mi; both yu, Aaron, Nadab, Abihu and di seventy eldas for Israel and wen una still dey far from where I dey, make una bow woship mi. Na only Moses go kom near mi, but make di odas nor kom near and make di rest pipol nor klimb with am.”
So Moses tell di pipol wetin God tok and di pipol ansa, “Wi dey ready to do evritin wey di Oga awa God kommand.”
Den Moses rite di word wey God tok. For early morning, e build altar for under di mountin kon arrange and stand twelf stones; one for each of di twelf tribes. E send some yong Israel men and dem go offa burn ofrin kon sakrifice one yong melu as peace ofrin to God. Moses take half of di blood, pour am inside some basin, den e sprinkol di remainin half on-top di altar.
So e take di Kovenant Book kon read am make all di pipol hear and dem sey, “Wi dey ready to do and obey all di word wey di Oga awa God tok.”
So Moses take di blood and e sprinkol am for di pipol body kon sey, “Dis na di kovenant blood wey God don make with una akordin to dis word.”
Moses and Aaron, Nadab and Abihu and di seventy eldas for Israel kon go di mountin 10 and dem si Israel God. Sometin wey bi like karpet wey dem take safaya stone make dey under en leg and e klear like sky. 11 But God nor distroy Israel leaders even doh dem si am kon chop and drink for en present.
Moses For Mount Sinai
12 Den God tell Moses, “Make yu klimb di mountin and I go give yu di law and kommand wey I rite for small flat stone, so dat yu go fit tish di pipol.” 13 So Moses and Joshua wey dey follow am kon go di mountin, den Moses klimb go meet God.
14 Before Moses go, e tell di eldas sey, “Make una wait for mi for here, until I go kom back. Aaron and Hur dey with una. Anybody wey get matter against anoda pesin, make e go meet dem and dem go setol am.”
15 Moses klimb go di mountin wey di kloud kover. 16 God glory dey on-top Mount Sinai and di kloud kover am for six days. For di sevent day, God kon koll Moses from inside di kloud. 17 From where di pipol dey, dem si God glory on-top di mountin like fire wey dey burn. 18 Moses enter inside di kloud wen e klimb di mountin and e stay der for forty days and forty nites.