23
God Judgement
“Make una nor dey tok wetin una eye nor si. Make una nor join wiked pipol lie for pesin head.
“Make una nor follow pipol do wiked tins; for inside yard, make una nor tok wetin una eye nor si, bikos plenty pipol dey tok am to take win dia kase and make una nor lie against poor pesin for kourt.
“If una si una enemy melu or donkey wey waka lost, make una do evritin to make sure sey una return am to di owner. Pesin wey hate una, if una si en donkey dey struggol bikos of di load wey e karry, make una nor waka pass, but make una help am.
“Make una nor give bad judgement to poor pesin for kourt.
“Make una nor akuiz pesin for wetin e nor do and make una nor kill good pesin, bikos I nor go free anybody wey do like dat.
“Make una nor take bribe, bikos bribe dey blind pesin eye and spoil good pipol.
“Make una nor sofa or opress strenjas wey dey stay with una. Unasef know wetin e mean to bi strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.
Di Sabat Day And Di Feast
10 “For six years, make una plant and harvest wetin una plant. 11 But for di sevent year, una must allow di land rest and make una leave am, so dat poor pipol wey dey with una, go chop wetin grow for di land and di animals go chop wetin remain. Una must still do like dis for una vineyard and olive farm.
12 “Una go work for six days, but make una nor work for di sevent day, so dat una melu, donkey, slave and strenjas wey dey work for una, go rest.
13 “Make una do evritin wey I tell una and una nor go pray or swear to any oda god. Make I nor ever hear dia name for una mout.
Di Three Main Feast
14 “Evry year, una go celebrate three times to take honor mi. 15 For di mont wey dem dey koll Abib, una go celebrate di bread wey nor get yist feast and for seven days, una go dey chop bread wey nor get yist, just as I kommand una wen una komot from Egypt. Nobody go kom meet mi with empty hand. 16 Make una still celebrate Harvest Feast wey bi di first fruit from evritin wey una plant for una land. Una go still celebrate Tanksgivin Feast wey bi di Shelta Feast wen di year end and for dis time, una go don gada all una harvest from di farm. 17 Three times for di year, all doz wey bi man go-go meet di Oga dia God.
18 “Make una nor offa my sakrifice blood with bread wey get yist. And di animal fat wey dem sakrifice, must nor remain till di next morning.
19 “Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm to di Oga una God house.
“Make una nor kook yong goat wey still dey suck en mama breast.”
Di Angel Wey Dey Naw
20 “I go send one angel wey go protet una for front as una dey go and e go bring una kom di place wey I don prepare for una. 21 Make una listin and obey en vois; make una nor disobey am, bikos e nor go forgive una sins and e dey ansa my name too. 22 But if una obey am kon do all di tins wey I tell una, den I go bi enemy to doz wey bi una enemies and I go fight doz wey dey fight against una. 23 My angel go-go for una front till una rish Amor, Hit, Periz, Kanaan, Hiv and Jebus pipol land and I go distroy dem for una. 24 Make una nor bow or serve dia gods kon do wetin dem dey do. But una must distroy dem finish kon skata dia juju to pieces.
25 “If una serve di Oga una God, E go bless una bread and wota kon remove all una sickness. 26 Evry woman go get shidren and doz wey get belle for una land, go must born pikin and una go get long life.
27 “I go put my fear for inside doz wey una go fight kon distroy dem; I go make all una enemies run from una. 28 I go send fear like ant go drive Hiv, Kanaan and Hit pipol komot before una go rish der. 29 I nor go take one year drive all of dem komot, so dat di land nor go turn to wildaness and wild animals nor go plenty for der. 30 Na small-small I go take drive dem komot until una go plenty kon take-ova. 31 Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.
32 “Make una nor enter kovenant with dem or with dia gods. 33 Make dem nor stay una land, so dat dem nor go make una sin against mi, bikos if una serve dia gods, I go distroy una.”