30
Ofrin Altar
“Yu go take akasia wood take make altar to burn incense. E go long rish one fit and half and na so too e go wide rish; e go bi four korna. En horns go bi three fit for di four korna wey bi di same wood as di altar. Yu go kover di top; all di four side and en horns wey bi pure gold, den kon take gold round am. Yu go make two gold ring under di borda for di two side, so dat e go hold di poles wey dem go take karry am. Yu go take akasia wood take make poles kon kover dem with gold. Den make yu put di incense altar for di front of di curtain wey dey di Testimony Box front (before di sakrifice place wey dey on-top di Testimony Box), where I go for meet yu. Evry morning wen Aaron kom prepare di lamp, e go burn sweet incense for di altar. And evry evening wen e lite di lamp, e must still burn incense for God present. Dem go dey do dis tin from one generashon go rish anoda. Make yu nor burn incense wey nor holy for di altar or any bad animal, korn or even pour drink ofrin on-top di altar. 10 Wons evry year, Aaron go klean di altar with blood from di horn and dem go dey do like dis from one generashon go rish anoda, bikos e dey holy to Oga God.”
Tabanako Money
11 God kon tell Moses, 12 “Wen ever yu dey kount Israel pipol akordin to dia nomba, anybody wey dem kount go pay for en life to di Oga dia God, so dat bad tin nor go happen to dem wen yu dey kount dem. 13 Anybody wey dem kount go give small silva as holy ofrin to Oga God. (Di amount na half shekel wey bi twenty gerah.) 14 Doz wey don rish twenty years, must give dis holy ofrin to God. 15 Wen una one give dis ofrin to God, so dat una go dey rite with am, rish pipol and poor pipol go pay di same tin. 16 Yu go kollect dis money from Israel pipol kon use dem take maintain di Tabanako. Bikos of dis, Israel pipol go always dey Oga God mind and E go klean una life.”
Di Bronze Basin
17 God tell Moses, 18 “Yu go still make bronze basin with bronze stand. Yu go put wota inside am kon put am between di tent wey dem for dey do meetin and di altar. 19 Aaron and en sons go use di wota take wosh dia hand and leg. 20 Wen ever Aaron and en sons dey enter di Tabanako go meet God or to go burn ofrins, dem must wosh demsef with wota, so dat dem nor go die! 21 Dem must always dey wosh dia hand and leg, so dat dem nor go die. Dis law na for dem and dia shidren forever.”
Di Anointin Oil
22 Den God tell Moses, 23 “Make yu selet betta spices like: twelf and half pounds of pure myrrh, sinamon wey get betta smell and make e bi six and one kwota pounds, sugarcane go bi six and one kwota pounds, 24 twelf and half pound of kassia and una go measure dem as dem dey measure di Tabanako shekel. Yu go still bring one gallon of olive oil. 25 Di anointin oil wey dem mix like perfume, go dey holy and dem go dey use am for God work. 26 Yu go use di oil take anoint di tent where dem for dey do meetin, di Testimony Box, 27 di tabol and all en material; di lampstand and wetin follow am, di incense altar, 28 di burnt ofrin altar and evry oda tin, di basin and en lampstand. 29 Den yu go santify dem and dem go dey holy. Anytin wey tosh dem go dey holy too. 30 Yu go anoint and santify Aaron and en sons, so dat dem go fit serve as my priest. 31 Make yu tell Israel pipol, ‘Una go always dey use dis holy anointin oil anytin una dey do God work. 32 Make una nor rub am for pipol body and make una nor make any oda oil wey bi like am. E dey holy and e must dey holy to una. 33 Anybody wey make perfume like am or take am rub strenja, dem go drive am komot from di kommunity.’ ”
Di Incense
34 God kon tell Moses, “Make yu take spices like: gum, resin, onyx, galbanum and pure frankincense and dem go bi di same amount. 35 Use dem take make incense wey dem mix with perfume. E must dey smooth, pure and holy. 36 Yu go grind some to powder, den put some for di Testimony Box wey dey inside di tent where dem for dey do meetin; di place where I go for meet yu. Na-im must dey holy pass to yu. 37 And yu must nor make dis kind perfume for yorsef, bikos dis one na for God and e must dey holy to yu. 38 Anybody wey make anytin like am, dem go drive am komot from di kommunity.”