31
God House
God tell Moses, “Si, I don koll Bezalel wey bi Uri pikin wey en grand-papa kom from Hur tribe for Judah. I don put my Spirit inside am, so dat e go know how to do difren work. E know how to design some fine tins with gold, silva and bronze and how to kut wood and set stones. E still know how to do kraft work well-well. I don sey make Oholiab wey bi Ahisamak pikin from Dan tribe, work with am. I don give special skill to all dis pipol wey sabi work, so dat dem fit make all di tins wey I kommand yu to do: di Tabanako; di Testimony Box; di atonement box kover wey dey on-top; all di tins wey dey inside di Tabanako; di tabol and di tins wey dey on-top; di pure lampstand with all di tins wey hold am, di incense altar, di burnt ofrin altar with all di tins wey e dey use; di basin with en stand; 10 di garment wey dem weave; di holy garment wey Aaron and en sons go wear to take serve as priest; 11 di anointin oil and di sweet incense for di holy place. Di men must make evritin, just as I kommand yu.”
Sabat Day Law
12 God kon tell Moses, 13 “Go tell Israel pipol sey, ‘Una must keep my Sabat Day, di day wey I dey rest, bikos na sign between mi and una thru-out una generashon and e dey show sey na mi bi di God wey choose una. 14 Una must keep di Sabat Day, bikos e dey holy to una. Anybody wey work for dat days, must die. 15 Una get six days to work, but di sevent day wey bi Sabat Day, na to rest, bikos e dey holy to God; anybody wey work for di sevent day, must die. 16 Israel pipol must keep di Sabat Day and obey am from one generashon go rish anoda. Dis kovenant go last forever. 17 Na sign between mi and Israel pipol forever. Bikos God use six days take kreate di heaven and di eart and E rest for di sevent day.’ ” 18 Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.