35
Sabat Day Law
Moses gada Israel pipol kon tell dem, “Dis na di word wey God sey una must do. Una fit work for six days, but for di sevent day wey dey holy to una, na Sabat Day wen una go to take rest and woship God. Anybody wey work, go die. Nobody must lite fire for en house for di Sabat Day.”
Pipol Wey One Work
Moses kon tell Israel pipol, “Dis na di word wey God kommand. Make una take ofrin kom give God. Make evribody give ofrin from en heart as e fit do; ofrin wey bi gold, silva, bronze, blue, purpol and red wool, fine linen, goat hair, ram skin wey dem dye with red, fine leda, akasia wood, olive oil for di lantan, spices for di anointin oil and for di incense wey get good smell. Onyx stones and oda difren stones to set for di priest garment and di Breast Plate.
Tins Wey Dey Tabanako
10 “Anybody among una wey sabi work well-well, make e kom so dat dem go make all di tins wey God kommand: 11 di Tabanako with en tent, en kover, en klips, en frame, en cross bars, en post and wetin dem go stand put; 12 di box with en poles, di kover and di klot to take kover am, 13 di tabols with en poles and all en kontaina and di bread for en present; 14 di lite, di lampstand and di tins wey follow am; di lamp cup and oil for di lite; 15 di incense for di altar with en poles and di anointin oil; di incense wey get good smell and di curtain for di Tabanako gate; 16 di altar for di burnt ofrin with en bronze frame wey dey on-top and all wetin e dey use; di wosh-hand basin and en stand, 17 di curtain for di kourtyard, en post and en stand; di curtain for di kourtyard gate; 18 di Tabanako tent peg; di kourtyard tent peg and dia rope; 19 di garment wey dem weave to take serve for di Holy Place; di holy garments for Aaron and di garments for en sons to take serve as priest.”
Di Pipol Ofrin
20 Afta evritin, Israel pipol kon waka leave Moses. 21 And evribody wey en heart move am and en spirit like to give kon bring ofrin for God. Dem bring all di tins wey dem nid for di Tabanako, di tins wey dem go dey use do work for der and di tins for di holy garment. 22 Na both men and wimen kom, dat na di pipol wey dia heart like to give and dem bring dress pins, ear-rings, rings and ornament. Dem still bring difren tins wey dem make with gold as special ofrin to God. 23 And evribody wey get blue, purpol and red wool, fine linen, goat hair, ram skin wey dem dye to red and fine leda, bring dem kom. 24 All doz wey get silva or bronze give dem as ofrin to God and doz wey get akasia wood bring dem kom make dem take work.
25 All di wimen wey know how to weave and sew bring wetin dem don weave; both blue, purpol and red wool with fine linen. 26 And di wimen wey dia mind move dem kon weave all di goat hair to wool. 27 Di leaders bring onyx stones and oda ones to take set di priest garment and di Breast Plate front. 28 Dem still bring spices, olive oil for di lite, di anointin oil and di incense wey get good smell. 29 Nobody force Israel pipol as dem dey give dia ofrin to God. Evry man and woman bring as en heart move am to bring, so dat dem go take am do all di work wey God kommand dem thru Moses.
Men Wey Go Build Di Tabanako
30 Den Moses tell Israel pipol, “God don koll Bezalel wey bi Uri pikin and Hur grand-pikin, wey kom from Judah tribe. 31 E don full Bezalel with en Spirit and E gi-am betta wisdom and undastandin, so dat e go fit do difren tins. 32 E sabi use gold, silva, bronze and e dey design too. 33 E sabi kut and set stones and dey use wood take do art work. 34 God give dis wisdom and undastandin to en and Oholiab wey en papa na Ahisamak from Dan tribe and dem go fit tish odas. 35 God give dem special skill to design with blue, purpol and red wool with fine linen and to weave dem too. Dem sabi dia work well-well.”