36
So God give wisdom and undastandin to Bezalel, Oholiab and all di pipol wey fit work, so dat dem go fit do anytin wey go help as dem dey build di Tabanako kon do evritin just as God kommand.
Di Pipol Gift
Den Moses tell Bezalel, Oholiab and evribody wey get handwork wey God don give wisdom and wey get mind to work sey, “Make una bigin work.” Moses give dem di ofrins wey Israel pipol bring to take do di work for di Tabanako and di pipol still dey bring ofrin evry morning. So all di pipol wey fit work wey dey di sanctuary leave dia work. Dem go meet Moses kon sey, “Di tins wey di pipol don give don too many to komplete di work wey God kommand sey make wi do!”
Den Moses send message go evriwhere for di kamp sey, “Make nobody bring more ofrin for di Tabanako work again.” So di pipol kon stop to give. All di tins wey di pipol bring pass wetin dem nid to take do di work.
Di Tabanako
All di pipol wey sabi work, make ten curtain for di Tabanako with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon design am with image wey bi like angel. One curtain long rish forty-two fit kon wide rish six fit. All di curtains na di same size. 10 Dem join five curtains togeda to make one curtain and na so too dem join di oda six curtains togeda. 11 Den dem take blue material make shape for di korna for di curtain end for one set; dem still do di same tin along di korna for di curtain end for di sekond set. 12 Dem make fifty-fifty shape for di first curtain and for di curtain end wey dey di sekond set and di shapes dey opposite each oda. 13 Den dem make fifty gold hook take join di curtains togeda, so dat di Tabanako go bi one.
14 From di eleven curtain wey dem make from goat hair, dem use won take kover di Tabanako. 15 One curtain long rish forty-five fit and wide rish six fit; di eleven curtains, na di same size. 16 Bezalel join five togeda for one set and di remainin six for anoda set. 17 E still make fifty shape along di korna for di curtain end for one set and fifty for di curtain for di sekond set. 18 E still make fifty bronze hook to take join di tent togeda, so dat e go form one kover. 19 E make two kover; di first one na ram skin wey dem dye with red and di oda one na fine leda to take kover di first one.
20 E take akasia wood make di Tabanako frames wey stand. 21 Each frame long rish fifteen fit and e wide rish two and one kwota fit. 22 Each frame get two face wey mash each oda, so dat dem fit join di frames togeda. All di frames get di same face. 23 Dem make twenty frame for di sout-side 24 and forty silva base under each frame wey go hold di two face. 25 For di nort side for di Tabanako, e still make anoda twenty frame, 26 with dia forty silva bottom; two bottom under each frame. 27 For di west side for di Tabanako, e make six frame for am; 28 with two frames for di Tabanako korna for back. 29 For di two korna, e doubol am for di bottom kon join dem togeda for top with one ring. Na so e do for di two kornas. 30 Na eight frame e make and dia silva bottom na sixteen; two bottom for each frame.
31 Den e use akasia wood take make cross bar; five na for di frames for di nort side for di Tabanako 32 and five na for di frames for di sout-side for di Tabanako. E still make five bar for di frame wey dey di Tabanako back for west. 33 E make di middle bar from one end to di oda for where di oda frames dey. 34 Den e take gold wrap am kon make gold ring wey go hold di bar dem.
35 Den e use blue, purpol and red wool with fine linen wey dem weave take make di curtains kon design am with angel. 36 E take akasia wood make four post with four gold hook. E wrap dem with gold kon put dem on-top four silva bottom.
37 For di Tabanako gate, e use blue, purpol and red wool with fine linen wey dem weave, take make anoda curtain kon dekorate am. 38 E hook di curtains for five post. E dekorate di top and dia hook with gold; but na bronze e take make di five bottom.