37
Di Kovenant Box
Bezalel make di box with akasia wood; e long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches and e high rish two fit three inches. E wrap am with pure gold, both for inside and outside. Den e take gold make borda round am. E make four gold rings kon tie dem for di four korna with two ring for one side and anoda two ring for di sekond side. Den e use akasia wood take make poles kon wrap dem with gold. E put di poles inside all di ring for di box korna, so dat dem go fit karry di box.
E still make di kover with pure gold and e long rish three fit nine inches kon wide rish two fit three inches. E melt gold take make two angel kon put dem for di two end for di kover. One angel for one end and di oda angel for di oda end. E make dem, so dat dem go bi di same with di kover. And di angels spread dia feada, so dat e go kover di box. Dem dey protet di box as dem face each oda.
Di Tabol
10 Bezalel use akasia wood take make di tabol; e long rish three fit; wide like one fit six inches and e high rish two fit three inches. 11 E kover am with pure gold kon use gold do borda round am. 12 E still make frame for am wey wide rish three inches kon take am round am and e make gold borda for di frame. 13 Den e make four gold rings kon tie di rings for di four korna where di four legs dey. 14 Di rings dey near di frame to kreate shance for di poles wey karry di tabol. 15 Bezalel make dis poles with akasia wood kon dekorate dem with gold. 16 Den e use pure gold make special kontaina for di tabol tins like: plates, cups, jars and bowl wey dem go use take pour di wine ofrin.
Di Lampstand
17 Bezalel melt pure gold take make di lampstand. E make all di lampstand with en dekorashon with one material; di bottom, en shaft, en cups, di fine flower, en small-small seed and di petal. 18 Di lampstand get six branches wey kom out from all en side; tree branches from each side. 19 Each of di six branches get three cup wey dem design like flower wey get small-small seeds and dem dey shine. 20 Four cups wey get shape like almond flower wey get small-small seed, dey for di lampstand. 21 E get small-small seed under di first two branches wey kom out from am and na so e bi for di six branches with two branches afta each oda. 22 Dia small-small seed and branches na from di same material; all of dem na pure gold wey dem melt. 23 E still make seven lamp for di lampstand, with trimma and tray wey bi pure gold. 24 E make di lampstand and all di tins wey follow am with seventy-five pounds of pure gold.
Incense Altar
25 Bezalel use akasia wood take make di incense altar. E long like one foot and half and na so e wide rish too, e kon bi skware. E high rish three fit. Na one material e still use make en horns. 26 E design am with pure gold both for di top, en four wall and en horns, den e use gold take make borda round am. 27 E still make two gold rings for am under en borda for di two side, so dat e go hold di poles wey dem go take karry dem. 28 E take akasia wood make di poles kon design dem with gold. 29 E make di holy anointin oil and di incense wey get good smell, just like pesin wey sabi make perfume, dey do.